1 God sey,
2 Only dem go Egypt for proteshon kon beg Fero make e guide dem,
3 But na shame una go get from Fero proteshon,
4 Aldo, Egypt leaders dey Zoan
5 God go disgrace Israel pipol,
6 Dis message na about di animals for Negev:
7 Egypt pipol nor go fit help dem at-all
8 Naw, make yu go rite am down for dia present;
9 Bikos dis pipol sturbon and dey lie well-well;
10 Dem tell di pesin wey dey si vishon sey,
11 “Nor do good again, but make yu kom join us.
12 Bikos of dis, di Oga wey bi God for Israel sey,
13 So na dis sin go distroy una.
14 E go skata for groun like pot wey break to pieces
15 Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok:
16 Instead, una sey, ‘No! Wi go enter awa horse kon run,’
17 Only one of una enemies soja go kill 1,000 of una,
18 Bikos of dis, God dey ready to pity for en pipol;
19 Una go stay for Zion! Jerusalem pipol nor go kry again. Wen God hear as una dey kry with pain, E go kom save and help una. Yes! E go ansa wen una kry for help.
20 Aldo, God go give una sofa chop like food kon make una drink pain una; but E go still dey with una to tisha una. Una go si una tisha with una own eye.
21 Una go hear one vois dey tok from una back sey, “Na di korrect way bi dis, make una waka pass der,” weda una dey waka go rite or left.
22 Una go distroy una juju wey dem make with silva and gold. Una go trowey dem like rag wey dem take klean groun kon sey, “Make una take dem komot here.”
23 God go pour wota put for di seed wey una plant and di groun go produce plenty food for una. For dat time, una animals go chop betta green grass for field.
24 Di melu and oda animals wey una take dey work for una field, go dey chop betta-betta food.
25 For dat time wen dem kill pipol well-well and di towas don fall, wota go dey flow kom from evry mountin and hill.
26 Full moon lite go shine like sun for aftanoon and sun lite go shine seven times pass as e dey shine before and e go bi like seven days lite. Den God go join en pipol bones wey bin break kon heal all dia wound.
27 Si! God dey kom from far with strong vexnashon and great glory.
28 Wen E shaut for war,
29 But una go sing just as una dey do
30 God go shaut well-well kon fight with pawa.
31 True-true, God vois go skata Assyria pipol,
32 Evry blow wey E give dem,
33 Dem don already prepare di place