1 Na for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya bi king for Judah, naim God take show dis message to Isaya, Amos pikin, about Judah and Jerusalem pipol.
2 Heaven and eart, make una listin to wetin God tok:
3 Melu know en owner, donkey sef know who dey gi-am food,
4 Una own don finish like who don die,
5 Israel pipol, wetin make una still wont
6 From una head go rish una leg,
7 Una land don skata and fire don burn una towns finish.
8 Na only Jerusalem remain and e bi like one small house
9 If to sey Oga God wey get pawa nor let some of di pipol survive,
10 So Sodom leaders, make una listin to wetin God dey tell una.
11 E sey, “Una sakrifice nor mean anytin to mi.
12 Who sey make una dey bring dis animals
13 Make una stop to bring una yuzles ofrins
14 I hate una new moon festival and di oda feast
15 Wen una raiz una hand dey pray,
16 Make una go wosh unasef klean
17 Make una learn to do good;
18 Afta una don do like dat, den God go sey,
19 If una obey mi,
20 But if una sin against mi, una go die.
21 Di town wey dey faithful before,
22 Jerusalem pipol, before-before, una bi like silva,
23 Una leaders don rijet mi and na tif bi dia friends;
24 Naw, make una listin to wetin Israel God wey get pawa, dey tok,
25 I go take akshon against una.
26 I go give una betta rulers with doz wey go advise una well
27 Bikos God dey holy, E go save Jerusalem
28 But E go kill anybody wey dey sin and fight against am.
29 Una go shame for unasef,
30 Una go fade like oak tree wey dey die;
31 Just as dem dey distroy grass with fire,