1 My darlin, yu too fine!
2 Yor tit dey white like sheep wey dem just barber en hair kon wosh en body klean.
3 Yor lips bi like red klot;
4 Yor neck fine well-well like David towa and e round and smooth
5 Yor two breast bi like gazelle or deer
6 Before di morning breeze go blow and darkness go disappear,
7 My love, yu too fine
8 My wife to bi, make yu follow mi from Lebanon.
9 My sista and wife, yu don tif my heart!
10 My sista and wife to bi, yor love dey sweet mi for body.
11 My wife to bi, yor lip sweet like honey,
12 My sista and wife, yu bi my sekret gardin;
13 Yu bi royal gardin wey pomegranate fruit and fine fruit
14 Nard and saffron flower;
15 Yu bi gardin wey get fountain;
16 Breeze from nort, make yu wake-up!