1 Dis na wetin Oga God show mi for vishon: I si as E dey prepare many lokust to kom attack all di plant for di land. Dis tin happen afta dem don harvest di king share and di remainin plant dey grow kom out.
2 For my vishon, I si di lokust dey chop all di plant wey dey grow for di land, so I sey,
3 So God shange en mind kon sey, “Wetin yu si, nor go happen again.”
4 God kon show mi anoda strong vishon. For dis vishon, I si as E dey ready to ponish en pipol with fire. Di fire burn di big sea, den e kon start to burn di land.
5 Den I sey,
6 So God shange en mind again kon sey, “Dis one nor go happen too.”
7 I kon si anoda vishon. For dis vishon, I si God stand near one wall wey dem measure well before dem build am and di ruler dey en hand.
8 E kon ask mi, “Amos, wetin yu dey si?” I ansa, “Na ruler.” Den E sey,
9 I go distroy all di place
10 Amazaya wey bi priest for Bethel kon send message go give King Jeroboam for Israel sey: “Among all di pipol, na Amos dey plan against yu and di land nor go fit bear all wetin e dey tok.
11 Bikos dis na wetin Amos tok: ‘Jeroboam go die for war and dem go karry Israel pipol from dia land go anoda land as slave.’ ”
12 So Amazaya sey make dem tell Amos, “Komot for here, yu wey dey profesai! Yor tok don too mush! Make yu go Judah town and kontinue to prish for der, so dat dem go pay yu.
13 Nor profesai for Bethel again, bikos na here di king for dey woship for di main temple.”
14 Amos ansa, “I nor bi profet before and I nor bi profet pikin. Na shepad I bi and I dey kare for fig trees.
15 But God take mi from di shepad work wey I dey do kon sey make I go profesai to en pipol, Israel.
16 So naw, make yu listin to wetin God tok. Yu sey make I stop to profesai and warn Israel pipol; make I nor prish against Isaak family, abi?
17 Naw, Amazaya, God dey tell yu sey,