1 God don show ensef to Judah pipol.
2 Na Jerusalem E dey stay
3 Na der E for break di enemies wiked arrow, dia guide,
4 En glory and majesty dey shine as E dey
5 Awa strong enemies don skata.
6 My Oga wey bi Jakob God, wen Yu breath,
7 No wonder dem dey fear Yu well-well!
8 Na from heaven Yu dey judge yor enemies;
9 My God, Yu dey judge di pipol wey dey do wiked tins
10 True-true, di way Yu dey vex judge human being, go make dem praiz Yu.
11 So, wen una vow give di Oga una God, make una keep una promise.
12 E dey honbol prince and kings for dis eart,