Salmos 74

PCM

1 My God, wetin make Yu rijet us forever?

2 Make Yu remember sey na wi bi di pipol wey Yu choose since Yu kreate di world;

3 Make Yu waka round di town wey dem skata;

4 Na for der yor enemies dey shaut and sing sey, “Dem don win.”

5 Dem dey use dia axe

6 Dem use axe and knife take skata evritin

7 kon burn yor temple rish groun.

8 Den dem kon dey boast dey sey,

9 Naw, wi nor dey si yor mirakles again.

10 So God, na how long e go take

11 Wetin make Yu nor won use yor strong rite hand against dem?

12 But Yu God don bi my King since my grand-grand papa dem time

13 Yu divide di sea with yor pawa

14 Yu skata di wota juju head

15 Just as Yu get pawa to make wota and sea flow,

16 Na Yu get both day and nite;

17 Yu measure where di eart go rish

18 My God, si as di enemies dey curse Yu.

19 Make Yu nor let dis wiked animal distroy yor pipol.

20 Make Yu remember yor kovenant,

21 Make Yu nor let dem disgrace pipol wey dey sofa.

22 My God, make Yu raiz-up kon fight for mi.

23 Make Yu nor forget evritin wey yor enemies tok

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado