1 My Oga God, I don kom meet Yu make Yu protet mi.
2 If Yu nor save mi, dem go chop mi like sey dem bi lion
3 My Oga God, if I don do any wrong tin
4 if I sin against my friend
5 den make my enemies porshu and katch mi.
6 My God, make Yu vex raiz-up for mi, den kon fight my enemies!
7 Pipol for di world gada round Yu,
8 Bikos na Yu dey judge evribody,
9 Make Yu stop di bad tins wey wiked pipol dey do kon defend doz wey dey good,
10 Na God bi my guide!
11 God dey judge well.
12 If pesin nor gri turn from sin kom meet God,
13 E go ready en swod wey dey kill
14 Pesin wey karry wikedness
15 E dey dig deep pit for odas,
16 and di trobol wey e plan for odas,
17 So, I go tank God, bikos E dey judge well;