1 My God, make Yu save mi from my enemies.
2 Save mi from pipol wey dey do bad tins
3 My God, si as dem dey wait for korna to katch mi;
4 I nor do anytin bad, yet dem dey wait to attack mi.
5 My Oga wey bi kommander for heaven, Israel pipol God,
6 Dem dey waka round di town for nite
7 Make Yu listin to how dem dey curse mi
8 But Oga God, dey laf dem.
9 Na Yu bi my strent and I dey wait make Yu save mi!
10 My God wey love mi go help mi.
11 Make Yu nor kill dem just like dat,
12 Bikos of di bad-bad tins wey dem dey tok, bikos of di evil wey dey dia lips,
13 Make Yu distroy dem as Yu dey vex!
14 My enemies dey kom out for nite
15 Dem dey find food to chop and even wen dem si chop,
16 But for mi, I go sing about yor pawa.
17 Na Yu dey give mi strent,