1 My God, make Yu sorry for mi,
2 Pipol wey won si sey I fall,
3 But even as I dey fear,
4 I praiz God for wetin E don promise.
5 Evriday, dem dey kause wahala for mi.
6 Dem dey gada hide dey look mi;
7 So my God, make Yu distroy dem
8 Yu know di pains wey I dey face.
9 My enemies go run wen I koll Yu for help,
10 I dey praiz God for wetin E don promise.
11 I trust God well-well, so wetin go make mi dey fear?
12 My God, I go do wetin I vow to give Yu and tank Yu,
13 Yu don save mi from deat and Yu nor let mi fall at-all,