1 My God, listin to my prayer.
2 Abeg, make Yu listin kon ansa mi,
3 My enemies dey shaut for mi;
4 My heart dey beat for my chest and bikos of deat,
5 I just dey fear dey shake anyhow
6 I wish sey I get feada like dove,
7 I go fly go far; go rest for wildaness
8 I go kwik run go
9 So my God, make Yu konfuse and skata dia plans,
10 Both for day and nite,
11 Evritin don skata and na so-so to dey treaten
12 If to sey na enemy dey laf mi,
13 But na yu my klose friend;
14 Wi don tell each oda awa sekret;
15 Make deat distroy my enemies;
16 But I go koll my God
17 For morning, aftanoon and nite,
18 E go diliver and save mi from pipol
19 God wey dey rule forever go hear mi kon deal with dem,
20 Dem dey attack dia friends
21 Dia words dey smooth like butter,
22 So make una give all una trobol to God,
23 But Yu, my Oga God!