1 My God, na Yu dey protet mi; so make Yu nor let pipol disgrace mi.
2 Make Yu listin to mi kon kwik diliver mi.
3 Na Yu bi my rock and my guide.
4 Drag mi komot from di trap wey my enemies set for mi,
5 I don put my life for yor hand.
6 I hate pipol wey dey serve juju,
7 I go happy and dance for yor love wey nor dey fail,
8 Yu nor give mi to my enemies
9 My Oga God, make Yu sorry for mi,
10 I dey die bikos pain and sadnes don make my years short.
11 All my enemies dey laf mi and my neighbours hate mi;
12 Pipol don forget mi like sey I don die;
13 I don hear evritin wey dem dey tok and e dey make mi fear.
14 But my Oga God, I trust Yu,
15 My future dey yor hand.
16 Make yor favor shine on yor savant.
17 My God, nor let dem disgrace mi,
18 Make Yu klose dia lie-lie mout forever;
19 Si as yor favor great rish;
20 Yu dey guide and hide dem for yor present
21 Make praiz bi God own,
22 I kry to Yu as I dey fear kon sey,
23 All of una wey dey fear and obey God,
24 So evribody wey put dia trust for God hand,