1 I dey pray to Yu, my God wey bi my rock.
2 Make Yu listin to my prayer for mesi as I dey kry to Yu for help
3 Make Yu nor drag mi follow pipol wey dey do wiked;
4 Make Yu ponish dem for dia wikedness!
5 Dem nor kare about di tins wey God do or wetin God make with en own hand.
6 I go praiz God,
7 Na God bi my strent, my guide and I trust am with all my heart.
8 God dey give en pipol strent and en king dey save,
9 So God, make Yu save yor pipol!