1 My God, my God, wetin make Yu forget mi?
2 My God, na evriday I dey koll Yu, but Yu nor dey ansa.
3 Yu dey holy
4 Awa grand-grand papa dem trust Yu
5 Dem kry give Yu and Yu diliver dem.
6 But naw, I don turn worm instead of man.
7 Anybody wey si mi, dey laf mi.
8 “Nor bi dis man trust God?
9 Yet Yu allow my mama born mi well
10 Dem born mi put for yor hand and na Yu dey kare for mi.
11 So, make Yu nor too stay far from mi,
12 My enemies gada round mi like strong melu and wiked animals from Bashan.
13 Dem dey open dia mout against mi
14 My life bi like wota wey dem trowey and all my bones don skata.
15 My strent don dry like mold wey sun beat.
16 My enemies gada round mi like many dogs and bad-bad pipol dey kom katch mi.
17 Naw, I fit kount all my bones
18 Dem divide my klot among demsef.
19 My God, nor dey far from mi!
20 Make Yu save mi from di swod
21 Take mi komot from di lion mout
22 I go tok about yor name for where my kountry pipol dey.
23 Evribody wey dey fear God, kom make wi praiz am!
24 Bikos E nor leave or forget poor pipol as dem dey sofa.
25 I go praiz Yu for where yor pipol gada.
26 Make doz wey dem dey opress,
27 Di whole eart go know God kon run go meet am.
28 Bikos na God bi di king wey get pawa
29 Make rish pipol for di world kom woship am.
30 Awa shidren sef go serve Yu.
31 Dem go tell doz wey dem neva born naw about all di good tins wey God dey do.