1 Make wi tank God, bikos E dey good
2 Make wi tank God wey bi di oga of all gods,
3 Make wi tank di Oga God of all ogas,
4 Na-im bi di Pesin wey dey do wonderful tins wey dey sopraiz pipol,
5 Di Pesin wey make di heaven with en wisdom,
6 Di Pesin wey put di eart on-top wota,
7 Di Pesin wey make di great lite for heaven,
8 Di sun dey rule for day time,
9 and di moon and star dey rule for nite,
10 Di Pesin wey kill all di first-born for Egypt,
11 Den E karry Israel pipol komot from der,
12 E guide dem with en strong hand,
13 Na-im divide di Red Sea, bikos en love wey nor dey fail,
14 Den E take Israel pipol waka pass di river for dry land,
15 Na-im make Fero and en sojas die inside di Red Sea,
16 Na God lead en pipol pass di wildaness,
17 Di Pesin wey kill strong-strong kings for dem,
18 E still kill great and mighty kings too,
19 E kill King Sihon for Amor,
20 E kill King Og for Bashan,
21 Den E kon give dia land to en pipol,
22 E give di land to Israel pipol wey bi en savant,
23 Di Pesin wey dey remember and fight for us wen wi dey trobol,
24 den kon take us komot from awa enemies hand,
25 Di Pesin wey dey give food to evritin wey get life,
26 So make wi tank di Oga God wey dey heaven,