1 I love God, bikos E dey hear my vois
2 E dey listin to mi, so as long as I dey alive,
3 bikos deat kover mi like klot and di fear to die go grave,
4 So I koll God name:
5 Naw, make una si as God kind and good rish!
6 God dey protet pipol wey dia faith neva too strong and even wen I dey face deat,
7 So my soul go rest again,
8 Yes! E save mi from deat kon remove tears from my eyes,
9 I dey waka for God present
10 I get faith wen I sey,
11 As I dey vex, I kon sey,
12 So, wetin I go give God for evritin
13 I go dance bikos E diliver mi
14 I go keep my promise
15 God dey kare for en pipol and E dey pain am well-well
16 My God, I bi yor savant;
17 So I go tank God with sakrifice
18 Na for pipol present I go for
19 and na for God house wey dey Jerusalem.