Rute 2

PCM vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 E get one man wey rilate to Naomi husband, Elimelek family and en name na Boaz. E get money well-well and pipol know am for evriwhere for Betlehem.
1 Tinha Noemi um parente de seu marido, senhor de muitos bens, da família de Elimeleque, o qual se chamava Boaz.
2 One day, Rut wey kom from Moab kon tell Naomi sey, “Abeg, make I go di field go gada rice. I dey sure sey I go si pesin wey go let mi work with am.”
2 Rute, a moabita, disse a Noemi: Deixa-me ir ao campo, e apanharei espigas atrás daquele que mo favorecer. Ela lhe disse: Vai, minha filha!
3 So Rut kon go gada rice for di field wey bi Boaz, wey kom from Elimelek family, own.
3 Ela se foi, chegou ao campo e apanhava após os segadores; por casualidade entrou na parte que pertencia a Boaz, o qual era da família de Elimeleque.
4 For dat time, Boaz kom Betlehem kon greet di workers sey, “Make God dey with una!”
4 Eis que Boaz veio de Belém e disse aos segadores: O Senhor seja convosco! Responderam-lhe eles: O Senhor te abençoe!
5 Wen Boaz si Rut, e kon ask en savant wey dey show dem wetin to do sey, “Na where dis woman from kom?”
5 Depois, perguntou Boaz ao servo encarregado dos segadores: De quem é esta moça?
6 Di savant ansa, “Na di Moab woman wey follow Naomi kom back.
6 Respondeu-lhe o servo: Esta é a moça moabita que veio com Noemi da terra de Moabe.
7 E ask us, ‘Weda e fit follow di workers gada rice?’ And na since morning wey e kom e dey work hard kom rish na. E nor dey rest at-all.”
7 Disse-me ela: Deixa-me rebuscar espigas e ajuntá-las entre as gavelas após os segadores. Assim, ela veio; desde pela manhã até agora está aqui, menos um pouco que esteve na choça.
8 So Boaz tell Rut, “My pikin! Si, make yu listin well-well! Make yu nor komot here go gada rice for anoda farm. Yu nor nid to go anoda farm. Yu fit dey here work with my workers wey bi wimen.
8 Então, disse Boaz a Rute: Ouve, filha minha, não vás colher em outro campo, nem tampouco passes daqui; porém aqui ficarás com as minhas servas.
9 Look di farm wey di men for dey work, den follow di wimen for back. I go tell di men make dem nor trobol yu. Wen wota dey hongry yu, yu fit go di wota pot go drink from di wota wey di savants fetch.”
9 Estarás atenta ao campo que segarem e irás após elas. Não dei ordem aos servos, que te não toquem? Quando tiveres sede, vai às vasilhas e bebe do que os servos tiraram.
10 Rut knee down face groun for Boaz front kon sey, “Wetin make yu dey good and kare for mi, even doh yu know sey I bi strenja?”
10 Então, ela, inclinando-se, rosto em terra, lhe disse: Como é que me favoreces e fazes caso de mim, sendo eu estrangeira?
11 Boaz ansa, “Dem don tell mi evritin wey yu dey do for yor moda-in-law since wey yor husband die. How yu leave yor papa and mama and yor kountry kon stay with pipol wey yu nor know before.
11 Respondeu Boaz e lhe disse: Bem me contaram tudo quanto fizeste a tua sogra, depois da morte de teu marido, e como deixaste a teu pai, e a tua mãe, e a terra onde nasceste e vieste para um povo que dantes não conhecias.
12 God go bless yu for evritin wey yu dey do! Di Oga wey bi Israel God wey dey protet yu, go pay yu for all di good tins wey yu don do!”
12 O Senhor retribua o teu feito, e seja cumprida a tua recompensa do Senhor , Deus de Israel, sob cujas asas vieste buscar refúgio.
13 Rut kon sey, “My oga, yu really dey good to mi, bikos yu don trit mi like yor savant, even doh I nor bi yor savant!”
13 Disse ela: Tu me favoreces muito, senhor meu, pois me consolaste e falaste ao coração de tua serva, não sendo eu nem ainda como uma das tuas servas.
14 For di time wey dem won chop food for aftanoon, Boaz kon tell Rut, “Make yu kom chop some food! Make yu drink some wine too as yu dey chop yor bread!”
14 À hora de comer, Boaz lhe disse: Achega-te para aqui, e come do pão, e molha no vinho o teu bocado. Ela se assentou ao lado dos segadores, e ele lhe deu grãos tostados de cereais; ela comeu e se fartou, e ainda lhe sobejou.
15 Wen Rut stand up won go gada rice, Boaz kon tell en savants, “Make una let am gada rice for where rice many and make una nor stop am!
15 Levantando-se ela para rebuscar, Boaz deu ordem aos seus servos, dizendo: Até entre as gavelas deixai-a colher e não a censureis.
16 Apart from dat, make una put many rice head for groun, so dat e go si gada and make nobody stop am!”
16 Tirai também dos molhos algumas espigas, e deixai-as, para que as apanhe, e não a repreendais.
17 So Rut kon gada rice for di farm till evening. So, wen Rut look all wetin e gada, e heavy rish three pounds!
17 Esteve ela apanhando naquele campo até à tarde; debulhou o que apanhara, e foi quase um efa de cevada.
18 Rut karry di rice wey e gada kon go house and en moda-in-law kon si di rice wey e bring kom. Den Rut give Naomi di rice wey dem roast wey e chop remain for aftanoon.
18 Tomou-o e veio à cidade; e viu sua sogra o que havia apanhado; também o que lhe sobejara depois de fartar-se tirou e deu a sua sogra.
19 Naomi ask am, “Na where yu for gada rice today? Na where yu for go work? Make God bless di pesin wey do dis kind tin for yu!”
19 Então, lhe disse a sogra: Onde colheste hoje? Onde trabalhaste? Bendito seja aquele que te acolheu favoravelmente! E Rute contou a sua sogra onde havia trabalhado e disse: O nome do senhor, em cujo campo trabalhei, é Boaz.
20 Naomi kon tell Rut, “Make God bless am well-well, bikos God always dey keep en promise to doz wey dey alive and doz wey don die!” Naomi kon tell Rut, “Dis man rilate to us and na senior man for awa family.”
20 Então, Noemi disse a sua nora: Bendito seja ele do Senhor , que ainda não tem deixado a sua benevolência nem para com os vivos nem para com os mortos. Disse-lhe mais Noemi: Esse homem é nosso parente chegado e um dentre os nossos resgatadores.
21 Rut kon ansa, “Di man even tell mi sey, ‘Work with my savants until dem don gada evritin finish!’ ”
21 Continuou Rute, a moabita: Também ainda me disse: Com os meus servos ficarás, até que acabem toda a sega que tenho.
22 Naomi kon tell Rut, “My pikin, e good as yu dey work with en wimen savants. For der, nobody go wahala yu, just as dem fit do for anoda farm.”
22 Disse Noemi a sua nora, Rute: Bom será, filha minha, que saias com as servas dele, para que, noutro campo, não te molestem.
23 So Rut start to work with Boaz wimen workers kon dey gada rice with dem until di harvest finish. Afta dat time, Rut kon stay house with en moda-in-law.
23 Assim, passou ela à companhia das servas de Boaz, para colher, até que a sega da cevada e do trigo se acabou; e ficou com a sua sogra.

Ler em outra tradução

Comparar com outra