Romanos 2

PCM vs ARC

Sair da comparação
ARC Almeida Revista e Corrigida 2009
1 Pesin wey dey judge odas nor get eskuse for wetin e dey do and e nor matter who en bi. Bikos wen yu judge odas and yu dey do di same tin wey dem dey do, yu dey kondemn yorsef.
1 Portanto, és inescusável quando julgas, ó homem, quem quer que sejas, porque te condenas a ti mesmo naquilo em que julgas a outro; pois tu, que julgas, fazes o mesmo.
2 Wi know sey God nor dey lie wen E dey judge pipol wey dey do bad tins.
2 E bem sabemos que o juízo de Deus é segundo a verdade sobre os que tais coisas fazem.
3 Yu wey dey do tins wey yu sey make odas nor do! Yu tink sey yu go eskape God judgement?
3 E tu, ó homem, que julgas os que fazem tais coisas, cuidas que, fazendo-as tu, escaparás ao juízo de Deus?
4 May bi una dey take God kindness, patient and endurance as yeye tins. Una nor know sey God dey kind, bikos E wont make una turn from sin kom meet am?
4 Ou desprezas tu as riquezas da sua benignidade, e paciência, e longanimidade, ignorando que a benignidade de Deus te leva ao arrependimento?
5 But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins.
5 Mas, segundo a tua dureza e teu coração impenitente, entesouras ira para ti no dia da ira e da manifestação do juízo de Deus,
6 God go pay evry man akordin to wetin e do.
6 o qual recompensará cada um segundo as suas obras,
7 God go give life wey nor dey end to di pipol wey dey do good, wey wont glory, honor and long life.
7 a saber: a vida eterna aos que, com perseverança em fazer bem, procuram glória, e honra, e incorrupção;
8 But E go show en vexnashon and ponish doz wey bikos of long-trot rijet di trut kon dey do bad tins.
8 mas indignação e ira aos que são contenciosos e desobedientes à verdade e obedientes à iniquidade;
9 Anybody wey dey do bad tin, weda e bi Jew or Gentile, must sofa and receive ponishment.
9 tribulação e angústia sobre toda alma do homem que faz o mal, primeiramente do judeu e também do grego;
10 But God go give glory, honor and peace to anybody wey dey do good, weda e bi Jew or Gentile,
10 glória, porém, e honra e paz a qualquer que faz o bem, primeiramente ao judeu e também ao grego;
11 bikos God go judge evribody di same way.
11 porque, para com Deus, não há acepção de pessoas.
12 Even doh Gentile pipol nor get Moses Law, God still dey ponish dem wen dem sin, so Jew pipol wey get di law, wen dem sin, na di law go judge dem.
12 Porque todos os que sem lei pecaram sem lei também perecerão; e todos os que sob a lei pecaram pela lei serão julgados.
13 Bikos yu dey hear di law nor mean sey yu good for God eye, but na wen yu do wetin di law tok.
13 Porque os que ouvem a lei não são justos diante de Deus, mas os que praticam a lei hão de ser justificados.
14 Gentile pipol nor get di law, but dem dey use dia sense do wetin di law tok and dat one don turn law for dem, even doh dem nor know Moses Law.
14 Porque, quando os gentios, que não têm lei, fazem naturalmente as coisas que são da lei, não tendo eles lei, para si mesmos são lei,
15 Di way dem dey bihave show sey wetin Moses rite for di law, dey dia heart and dia mind dey tell dem sey, “Dis tins dey rite and e go kondemn or free us from wetin wi do.”
15 os quais mostram a obra da lei escrita no seu coração, testificando juntamente a sua consciência e os seus pensamentos, quer acusando-os, quer defendendo-os,
16 So just as I prish give una, na so e go bi for dat day, wen God go judge all di sekret tins wey dey pipol heart thru Jesus Christ wey bi en pikin.
16 no dia em que Deus há de julgar os segredos dos homens, por Jesus Cristo, segundo o meu evangelho.
17 Wot of yu wey sey yu bi Jew? Yu wey put yor hope for di law kon dey use God dey boast;
17 Eis que tu, que tens por sobrenome judeu, e repousas na lei, e te glorias em Deus;
18 yu know wetin God wont make yu do and yu don learn how to do good tins, bikos yu know di law.
18 e sabes a sua vontade, e aprovas as coisas excelentes, sendo instruído por lei;
19 Yu dey show blind pipol road and dey help doz wey dey for darkness si lite,
19 e confias que és guia dos cegos, luz dos que estão em trevas,
20 and yu dey tish foolish pipol and small shidren wey nor know anytin, bikos yu know sey, di trut and evritin wey man nid to know, dey for di law.
20 instruidor dos néscios, mestre de crianças, que tens a forma da ciência e da verdade na lei;
21 Yu wey dey tish odas, why yu nor fit tish yorsef? Yu wey dey prish sey make pipol nor tif, yu sure sey yu nor dey tif?
21 tu, pois, que ensinas a outro, não te ensinas a ti mesmo? Tu, que pregas que não se deve furtar, furtas?
22 Yu wey sey make pipol nor kommit adultery, yu nor dey kommit adultery? Yu wey sey yu hate juju, yu nor dey take tins wey dem keep for juju house?
22 Tu, que dizes que não se deve adulterar, adulteras? Tu, que abominas os ídolos, cometes sacrilégio?
23 Yu wey dey take di law boast, yu dey bring shame to God name, bikos yu dey disobey di law!
23 Tu, que te glorias na lei, desonras a Deus pela transgressão da lei?
24 Just as God word sey, “Bikos of una wey bi Jew pipol, Gentile pipol dey take God name make yeye.”
24 Porque, como está escrito, o nome de Deus é blasfemado entre os gentios por causa de vós.
25 Sekonsishon get value only if yu dey do wetin di law tok, but if yu nor dey obey di law, yu and di pesin wey dem neva sekonsaiz na di same.
25 Porque a circuncisão é, na verdade, proveitosa, se tu guardares a lei; mas, se tu és transgressor da lei, a tua circuncisão se torna em incircuncisão.
26 So if Gentile pipol wey dem nor sekonsaiz dey obey evritin for di law, yu nor tink sey God go take dem as pipol wey dem sekonsaiz?
26 Se, pois, a incircuncisão guardar os preceitos da lei, porventura, a incircuncisão não será reputada como circuncisão?
27 Yu nor know sey di pesin wey dem nor sekonsaiz go judge yu wey bi Jew, since yu dey break di law?
27 E a incircuncisão que por natureza o é, se cumpre a lei, não te julgará, porventura, a ti, que pela letra e circuncisão és transgressor da lei?
28 Pesin nor bi Jew bikos of wetin pipol si from outside. Di really sekonsishon nor bi wetin pipol dey si,
28 Porque não é judeu o que o é exteriormente, nem é circuncisão a que o é exteriormente na carne.
29 but di really Jew na pesin wey bi Jew for inside en heart, bikos sekonsishon nor dey tosh pesin heart. Na di Holy Spirit dey do dis kind work, nor bi di law wey dem rite down and dat pesin go dey receive praiz from God, even doh human being nor praiz am.
29 Mas é judeu o que o é no interior, e circuncisão, a que é do coração, no espírito, não na letra, cujo louvor não provém dos homens, mas de Deus.

Ler em outra tradução

Comparar com outra