Números 7

PCM vs NTLH

Sair da comparação
NTLH Nova Tradução na Linguagem de Hoje 2000
1 Wen Moses don set di Tabanako finish, e kon anoint and dedikate di tent, di altar and evritin wey dey inside.
1 No dia em que Moisés acabou de armar a Tenda Sagrada , ele a ungiu e a dedicou ao serviço de Deus, junto com todos os objetos da Tenda e do altar.
2 Den di leaders for Israel, di heads for di tribes kon give one ofrin. Na dis pipol bi leaders for di tribes and na dem dey monitor di kountin.
2 Então os chefes dos grupos de famílias, que eram líderes das tribos do povo de Israel, os mesmos homens que estavam cuidando da contagem do povo,
3 Di ofrin wey dem bring to God na: six truck and twelf melu. One truck na for two leader and one melu for each leader, so dem give dem to God for di Tabanako front.
3 trouxeram as suas ofertas a Deus, o Senhor , isto é, seis carroças cobertas e doze bois. Cada dois chefes ofereceram uma carroça, e cada um deles, um boi; e puseram tudo na frente da Tenda.
4 Den God tell Moses:
4 O Senhor disse a Moisés:
5 “Make yu kollect dis tins from dem kon give dem to Levi pipol make dem take do dia difren-difren work.”
5 — Receba as carroças e os bois a fim de serem usados para o serviço da Tenda; e dê essas ofertas aos levitas , a cada um de acordo com o serviço que faz.
6 So Moses give di truck and di melu to Levi pipol.
6 Então Moisés deu aos levitas as carroças e os bois.
7 E give two truck and four melu to Gershon pipol,
7 Aos descendentes de Gérson ele deu duas carroças e quatro bois, de acordo com o serviço que faziam.
8 four truck and eight melu to Merari pipol and na Itama, Aaron pikin dey direct dem for dia work.
8 Aos descendentes de Merari, também de acordo com o serviço deles, Moisés deu quatro carroças e oito bois. Esse serviço era dirigido por Itamar, filho do sacerdote Arão.
9 But Moses nor give Kohat pipol any truck or any melu, bikos na di holy tins wey dem karry for dia shoulder, bi dia work.
9 Porém Moisés não deu aos descendentes de Coate nem carroças nem bois, pois os objetos sagrados de que eles cuidavam tinham de ser carregados nos ombros.
10 Di leaders bring gift to take dedikate di altar wen dem don anoint am kon drop dem der.
10 Os chefes também trouxeram as ofertas para comemorar a dedicação do altar ao serviço de Deus. Quando eles já estavam prontos para apresentar as suas ofertas no altar,
11 Bikos God tell Moses sey, “Dem must give dia ofrin to take dedikate di altar; one leader for each day.”
11 o Senhor Deus disse a Moisés: — Os chefes, cada um no seu próprio dia, deverão apresentar as suas ofertas para a dedicação do altar ao meu serviço. As ofertas que cada um trouxe eram iguais: uma bandeja de prata pesando um quilo e meio; uma bacia de prata pesando oitocentos gramas, segundo a tabela oficial (a bandeja e a bacia estavam cheias de farinha de trigo misturada com azeite, para a oferta de cereais); um prato de ouro pesando cento e quinze gramas, cheio de incenso; um touro novo, um carneiro e um carneirinho de um ano para serem completamente queimados; um bode como oferta para tirar pecados; e, como oferta de paz, dois bois, cinco carneiros, cinco bodes e cinco carneirinhos de um ano.
12 Di one wey give en ofrin for di first day na Nahshon wey Amminadab born and na from Judah tribe e from kom.
12 — ausente —
13 En ofrin na one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, but na akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
13 — ausente —
14 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
14 — ausente —
15 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
15 — ausente —
16 one man goat for klean ofrin
16 — ausente —
17 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Nahshon, wey Amminadab born, give.
17 — ausente —
18 For di sekond day, Netanel wey Zuar born, wey dey lead Issakar tribe kon give en ofrin.
18 — ausente —
19 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
19 — ausente —
20 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
20 — ausente —
21 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
21 — ausente —
22 one man goat for klean ofrin;
22 — ausente —
23 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Netanel, wey Zuar born, give.
23 — ausente —
24 For di third day, Eliab wey Helon born, wey bi leader for Zebulun tribe kon give en ofrin.
24 — ausente —
25 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
25 — ausente —
26 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
26 — ausente —
27 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
27 — ausente —
28 one man goat for klean ofrin;
28 — ausente —
29 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Eliab, wey Helon born, give.
29 — ausente —
30 For di fourt day, Elizur wey bi Shedeur pikin, di leader for Reuben tribe kon give en ofrin.
30 — ausente —
31 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
31 — ausente —
32 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
32 — ausente —
33 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
33 — ausente —
34 one man goat for klean ofrin;
34 — ausente —
35 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Elizur, wey Shedeur born, give.
35 — ausente —
36 For di fift day Shelumiel wey Zurishaddai born, wey dey lead Simeon tribe kon give en ofrin.
36 — ausente —
37 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
37 — ausente —
38 one gold pan wey heavy rish ten shekel;
38 — ausente —
39 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
39 — ausente —
40 one man goat for klean ofrin;
40 — ausente —
41 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Shelumiel, wey Zurishaddai born, give.
41 — ausente —
42 For di sixt day, Eliasaf wey Deuel born, wey dey lead Gad tribe kon give en ofrin.
42 — ausente —
43 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
43 — ausente —
44 one gold pan wey heavy rish ten shekel;
44 — ausente —
45 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
45 — ausente —
46 one man goat for klean ofrin;
46 — ausente —
47 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Eliasaf, wey Deuel born, give.
47 — ausente —
48 For di sevent day, Elishama wey Ammihud born, wey dey lead Efraim pipol, kon give en ofrin.
48 — ausente —
49 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
49 — ausente —
50 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
50 — ausente —
51 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
51 — ausente —
52 one man goat for klean ofrin;
52 — ausente —
53 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Elishama, wey Ammihud born, give.
53 — ausente —
54 For di eight day, Gamaliel wey Pedahzur born, wey dey lead Manasseh tribe, kon give en ofrin.
54 — ausente —
55 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
55 — ausente —
56 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
56 — ausente —
57 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
57 — ausente —
58 one man goat for klean ofrin;
58 — ausente —
59 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Gamaliel, wey Pedahzur born, give.
59 — ausente —
60 For di ninet day, Abidan wey Gideoni born, wey dey lead Benjamin tribe, kon give en ofrin.
60 — ausente —
61 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
61 — ausente —
62 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
62 — ausente —
63 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
63 — ausente —
64 one man goat for klean ofrin;
64 — ausente —
65 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Abidan wey Gideoni born give.
65 — ausente —
66 For di tent day, Ahiezer wey Ammishaddai born, wey bi leader for Dan tribe, kon give en ofrin.
66 — ausente —
67 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
67 — ausente —
68 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
68 — ausente —
69 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
69 — ausente —
70 one man goat for klean ofrin;
70 — ausente —
71 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Ahiezer, wey Ammishaddai born, give.
71 — ausente —
72 For di elevent day, Pagiel wey Okran born, wey dey lead Asher pipol, kon give en ofrin.
72 — ausente —
73 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
73 — ausente —
74 one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;
74 — ausente —
75 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
75 — ausente —
76 one man goat for klean ofrin;
76 — ausente —
77 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Pagiel, wey Okran born, give.
77 — ausente —
78 For di twelft day, Ahira wey Enan born, wey bi leader for Naftali pipol, kon give en ofrin.
78 — ausente —
79 Di ofrin wey e give na: one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;
79 — ausente —
80 one gold pan wey heavy rish ten shekel;
80 — ausente —
81 one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;
81 — ausente —
82 one man goat for klean ofrin;
82 — ausente —
83 and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Ahira, wey Enan born, give.
83 — ausente —
84 Dis na di whole ofrin wey di leaders for Israel give for di altar, wen dem don anoint am: twelf silva plate, twelf shine-shine silva bowl and twelf gold pan.
84 — ausente —
85 Each silva plate heavy rish one hundred and three shekel and each shine-shine silva bowl heavy rish seventy shekel. All di silva vessel dem heavy rish 2,400 shekel, akordin to di sanctuary shekel.
85 — ausente —
86 Di twelf gold pans wey incense full heavy rish ten shekel and na akordin to di sanctuary shekel; all di pan wey bi gold heavy rish one hundred and twenty shekel.
86 doze pratos de ouro pesando um quilo trezentos e oitenta gramas (os pratos estavam cheios de incenso);
87 All di animal wey dem use for di burnt ofrin na twelf small melu, twelf ram, twelf man lamb wey bi one year, with dia korn ofrin and twelf man goat for klean ofrin.
87 como ofertas a serem completamente queimadas, doze touros novos, doze carneiros e doze carneirinhos de um ano, junto com as ofertas de cereais que acompanham essas ofertas; como ofertas para tirar pecados, doze bodes;
88 All di animals wey dem sakrifice for peace ofrin na twenty-four small melu, sixty ram, sixty man goat and sixty lamb wey bi one year. Dis na di whole ofrin wey dem give to take dedikate di altar afta dem don anoint am.
88 e, como ofertas de paz, vinte e quatro bois, sessenta carneiros, sessenta bodes e sessenta carneirinhos de um ano.
89 Naw, wen Moses don enter di tent, God kon tok to am for di Kovenant Box top; between di two image wey bi like angel wey dem dey koll cherubim.
89 Quando Moisés entrou na Tenda Sagrada para falar com o Senhor , ouviu a voz de Deus falando com ele de cima da tampa da arca da aliança , do meio dos dois querubins (Era assim que Deus falava com Moisés.).

Ler em outra tradução

Comparar com outra