Números 32

PCM vs BKJ

Sair da comparação
1 Naw Reuben and Gad pipol get many kattle. Wen dem si sey Jazer and Gilead land dey good
1 Ora os filhos de Rúben e os filhos de Gade tinham uma grande quantidade de gado; e quando viram a terra de Jazer e a terra de Gileade, eis que o lugar era lugar de gado.
2 dem kon go meet and tell Moses, Eleazar and di leaders sey,
2 E vieram os filhos de Gade e os filhos de Rúben, e falaram a Moisés e a Eleazar, o sacerdote, e aos príncipes da congregação, dizendo:
3 “Atarot, Dibon, Jazer, Nimrah, Heshbon, Elealeh, Sebam, Nebo and Beon,
3 Atarote, e Dibom, e Jazer, e Ninra, e Hesbom, e Eleale, e Sebã, e Nebo, e Beom,
4 di land wey God don give Israel pipol dey good for kattle and yor savants get kattle.
4 a terra que o SENHOR feriu diante da congregação de Israel é terra de gado; e os teus servos têm gado.
5 So wi wont beg make una give us dis land as awa propaty. Make una nor make us cross Jordan River with una.”
5 Portanto, disseram eles, se achamos graça aos teus olhos, que esta terra seja dada aos teus servos em possessão, e não nos leves a cruzar o Jordão.
6 Moses kon tell Gad and Reuben pipol sey, “Una won stay here make only una brodas go fight war?
6 E Moisés disse aos filhos de Gade e aos filhos de Rúben: Irão vossos irmãos para a batalha, e vós ficareis sentados aqui?
7 Why una won diskorage Israel pipol make dem nor cross Jordan River go di land wey God don give dem?
7 E por que desencorajais o coração dos filhos de Israel, para que não entrem na terra que o SENHOR lhes deu?
8 Una papa do di same tin wen I send dem from Kadesh Barnea go si di land.
8 Isto fizeram vossos pais, quando os enviei de Cades-Barneia, para ver esta terra.
9 Wen dem si di land from Eshkol Valley, dem kon diskorage Israel pipol, so dat dem nor go enter di land wey God don give dem.
9 Porque, quando eles foram até ao vale de Escol e viram esta terra, desencorajaram o coração dos filhos de Israel, para que não fossem à terra que o SENHOR lhes havia concedido.
10 So God kon dey vex dat day and E swear sey,
10 E a ira do SENHOR se acendeu naquele mesmo momento, e ele jurou, dizendo:
11 ‘Bikos dem nor follow mi with all dia heart, no one among dem from twenty years go wey komot from Egypt go si di land wey I promise sey I go give Abraham, Isaak and Jakob,
11 Certamente, nenhum dos homens que subiram do Egito, a partir de vinte anos de idade para cima, verá a terra que jurei a Abraão, a Isaque e a Jacó, porque não me seguiram completamente,
12 but Kaleb wey Jefunneh from Keniz born and Joshua wey Nun born go enter, bikos dem follow God with all dia heart.’
12 exceto Calebe, filho de Jefoné, o quenezeu, e Josué, filho de Num, porque seguiram ao SENHOR completamente.
13 So God vex for Israel pipol kon make dem waka anyhow for di wildaness for forty years, until all di pipol wey do bad before God, die finish.
13 E a ira do SENHOR se acendeu contra Israel, e ele os fez peregrinar pelo deserto quarenta anos, até que toda a geração que havia feito mal aos olhos do SENHOR foi consumida.
14 “Naw si, una don dey won bihave like una papa wey like sin. Una wont make God vex for Israel pipol again.
14 E eis que, levantastes no lugar de vossos pais, um grupo de homens pecadores, para aumentar ainda mais a ira do SENHOR contra Israel.
15 And if una nor follow am, E go leave una again for di wildaness and una go make am distroy odas.”
15 Porque se vos afastares dele, ele novamente os deixará no deserto, e destruireis todo este povo.
16 Den dem go near Moses kon sey, “Wi go build house here for awa animals and family,
16 E eles se aproximaram dele, e disseram: Edificaremos currais aqui, para nosso gado, e cidade para os nossos pequenos.
17 but wi go follow awa brodas go war and wi go lead for di attack until dem don setol for di land wey go bi dia own. Awa shidren go dey here for sometaim for di house wey wi build to take protet dem from di pipol wey get di land.
17 Mas nos prepararemos e nos armaremos, diante dos filhos de Israel, até que os tenhamos levado ao seu lugar; e os nossos pequenos habitarão nas cidades muradas, por causa dos moradores da terra.
18 Wi nor go-go awa house until all di tribe for Israel don get dia propaty.
18 Não voltaremos para nossas casas, até que os filhos de Israel, cada homem, tenham herdado a sua herança.
19 Wi nor go take any propaty for di oda side for Jordan River or for front, bikos wi don get awa share for dis east side for Jordan River.”
19 Porque não herdaremos com eles o outro lado do Jordão, nem mais além, porque a nossa herança está deste lado do Jordão, para o oriente.
20 Den Moses ansa dem, “If una go fit do dis tin kon dey ready to fight for God present
20 E Moisés lhes disse: Se fizerdes isto, se vos preparardes e armardes para ir à guerra perante o SENHOR,
21 and all una sojas cross Jordan River as God kommand kon attack awa enemies until God defeat dem
21 e cada um de vós, armado, cruzar o Jordão perante o SENHOR, até que ele haja expulsado os seus inimigos perante ele,
22 and wi take di land as awa own, den una fit kom back, bikos una don do di work wey una suppose do for God and for Israel pipol. Den God go give una di land wey dey east for Jordan River.
22 e a terra esteja subjugada perante o SENHOR; em seguida voltareis, e sereis inocentes perante o SENHOR e perante Israel; e esta terra será a vossa possessão, perante o SENHOR.
23 “But if una nor do wetin una promise, I dey warn una, bikos na sin una don kommit against God bi dat. Make una nor konfuse unasef; bikos una go must get di ponishment for una sin.
23 Mas se não fizerdes isto, eis que pecareis contra o SENHOR; e podeis ter certeza de que o vosso pecado vos achará.
24 So make una build towns for una shidren and house for una animals, but make una do wetin una tok!”
24 Edificai cidades para os vossos pequenos e currais para as vossas ovelhas e fazei aquilo que saiu da vossa boca.
25 Gad and Reuben pipol kon ansa, “Oga, wi go do wetin yu kommand.
25 E os filhos de Gade, e os filhos de Rúben falaram a Moisés, dizendo: Os teus servos farão aquilo que o meu senhor ordena.
26 Awa wifes, shidren and animals go dey here for Gilead.
26 Os nossos pequenos, as nossas esposas, os nossos rebanhos, e todo o nosso gado, estarão aí nas cidades de Gileade.
27 But all of us don ready to go fight, just as God kommand. Wi go cross Jordan River go fight, just as yu tok.”
27 Mas os teus servos cruzarão, cada homem armado para a guerra, perante o SENHOR, como disse meu senhor.
28 So Moses give Eleazar, Joshua and di oda leaders for Israel dis kommand sey:
28 E Moisés deu ordem a respeito deles a Eleazar, o sacerdote, e a Josué, filho de Num, e aos pais das tribos dos filhos de Israel.
29 “If Gad and Reuben pipol cross Jordan River go fight akordin to God kommand and if una konker di land with dia help, den una go give dem dis land as dia propaty.
29 E Moisés lhes disse: Se os filhos de Gade e os filhos de Rúben cruzarem convosco o Jordão, cada homem armado para a guerra perante o SENHOR, e a terra estiver subjugada diante de vós, então lhes dareis a terra de Gileade por possessão.
30 But if dem nor cross Jordan River and dem nor go fight with una, den na Kanaan land dem go for get dia own land and propaty.”
30 Mas se não cruzarem armados convosco, terão possessões entre vós, na terra de Canaã.
31 Den Gad and Reuben pipol ansa, “Oga, wi go do wetin God kommand us.
31 E os filhos de Gade e os filhos de Rúben responderam, dizendo: Aquilo que o SENHOR falou a teus servos, assim faremos.
32 Just as E kommand, wi go cross go Kanaan land go fight, so dat wi go get awa propaty for Jordan River east.”
32 Nós cruzaremos armados, perante o SENHOR, e entraremos na terra de Canaã, para que a possessão de nossa herança, deste lado do Jordão, possa ser nossa.
33 So Moses give Gad, Reuben and half for Josef first-born Manasseh tribe, all di aria wey bi Amor king, Sihon own and e still give dem king Og for Bashan own, plus di towns and kountries wey dey round dem.
33 E Moisés deu, aos filhos de Gade, e aos filhos de Rúben, e à meia tribo de Manassés, filho de José, o reino de Seom, rei dos amorreus, e o reino de Ogue, rei de Basã; a terra com as suas cidades nas costas, e as cidades do seu entorno.
34 Gad pipol kon ribuild Dibon, Atarot, Aroer,
34 E os filhos de Gade edificaram a Dibom, e Atarote, e Aroer;
35 Atrot Shofan, Jazer, Jogbehah,
35 e Atarote-Sofã, e Jazer, e Jogbeá;
36 Bet-Nimrah and Bet-Haran as strong towns, den dem make house for dia animals.
36 e Bete-Ninra, e Bete-Harã, cidades muradas, e currais de ovelhas.
37 Reuben pipol kon ribuild Heshbon, Elealeh, Kiriataim,
37 E os filhos de Rúben edificaram a Hesbom, e Eleale, e Quiriataim;
38 Nebo, Baal-Meon (dem kon shange di name) and Sibmah. Di towns wey dem build, dem kon give dem new names.
38 e Nebo, e Baal-Meom (com seus nomes mudados) e Sibma; e deram outros nomes às cidades que edificaram.
39 Makir wey Manasseh born, en shidren go Gilead, drive Amor pipol wey dey stay der kon take di land.
39 E os filhos de Maquir, filho de Manassés, foram para Gileade e a tomaram; e desapossaram os amorreus que estavam nela.
40 So Moses give Gilead to Makir, wey Manasseh born and e kon dey stay der.
40 E Moisés deu Gileade a Maquir, filho de Manassés, e ele habitou ali.
41 Naw, Jair wey Manasseh born kon go attack and take some small village and e name dem Havvot-Jair.
41 E Jair, filho de Manassés, foi e tomou as pequenas aldeias dali; e chamou-lhes Havote-Jair.
42 Den Nobah go attack and take Kenat and en village kon give dem en name, Nobah.
42 E Noba foi e tomou Quenate e as suas aldeias; e deu-lhe o nome de Noba, segundo o seu próprio nome.

Ler em outra tradução

Comparar com outra