Números 29
PCM vs ARIB
1 “ ‘For di first day for di sevent mont, una go gada woship mi. Una must nor do any work, bikos dat na di day wey dem go blow trumpet for una.
1 No sétimo mês, no primeiro dia do mês, tereis uma santa convocação; nenhum trabalho servil fareis; será para vós dia de sonido de trombetas.
2 Make una give burnt ofrin to God, di smell wey God go like: make una give one yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and all of dem must dey okay.
2 Oferecereis um holocausto em cheiro suave ao Senhor: um novilho, um carneiro e sete cordeiros de um ano, todos sem defeito;
3 Make una give di rite korn ofrin for flower wey dem mix with olive oil: three kilogram for flower with di melu; two kilogram with di ram,
3 e a sua oferta de cereais, de flor de farinha misturada com azeite, três décimos de efa para o novilho, dois décimos para o carneiro,
4 and one kilogram with each lamb.
4 e um décimo para cada um dos sete cordeiros;
5 Make una still give one man goat as sin ofrin and like dis, una go make di pipol holy.
5 e um bode para oferta pelo pecado, para fazer expiação por vós;
6 Make una give dis plus di normal burnt ofrin for di first day for di mont with en korn ofrin; di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin. Dis food ofrin get betta smell wey God like well-well.
6 além do holocausto do mês e a sua oferta de cereais, e do holocausto contínuo e a sua oferta de cereais, com as suas ofertas de libação, segundo a ordenança, em cheiro suave, oferta queimada ao Senhor.
7 “ ‘Make una gada woship God for di tent day for di sevent mont and make una nor chop food or do any work.
7 Também no dia dez deste sétimo mês tereis santa convocação, e afligireis as vossas almas; nenhum trabalho fareis;
8 But una must give burnt ofrin to God; di smell wey God dey like: una go give one yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
8 mas oferecereis um holocausto, em cheiro suave ao Senhor: um novilho, um carneiro e sete cordeiros de um ano, todos eles sem defeito;
9 Make una give di rite korn ofrin for flower wey dem mix with olive oil: three kilogram for flower with di melu, two kilogram with di ram,
9 e a sua oferta de cereais, de flor de farinha misturada com azeite, três décimos de efa para o novilho, dois décimos para o carneiro,
10 and one kilogram with each lamb.
10 e um décimo para cada um dos sete cordeiros;
11 Make una still give one man goat as sin ofrin and like dis, una go make di pipol holy and una go still give di evriday burnt ofrin with en korn ofrin.
11 e um bode para oferta pelo pecado, além da oferta pelo pecado, com a qual se faz expiação, e do holocausto contínuo com a sua oferta de cereais e as suas ofertas de libação.
12 “ ‘Make una gada woship God for di fifteent day for di sevent mont. Una go do dis to take honor God for seven days and una nor go do any work.
12 Semelhantemente, aos quinze dias deste sétimo mês tereis santa convocação; nenhum trabalho servil fareis; mas por sete dias celebrareis festa ao Senhor.
13 For di first day, una go give food ofrin to God, di smell wey God like well-well: una go give thirteen yong melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
13 Oferecereis um holocausto em oferta queimada, de cheiro suave ao Senhor: treze novilhos, dois carneiros e catorze cordeiros de um ano, todos eles sem defeito;
14 Make una give di rite korn ofrin wey bi flower wey dem mix with olive oil: three kilogram with each melu, two kilogram with each ram,
14 e a sua oferta de cereais, de flor de farinha misturada com azeite, três décimos de efa para cada um dos treze novilhos, dois décimos para cada um dos dois carneiros,
15 and one kilogram with each lamb.
15 e um décimo para cada um dos catorze cordeiros;
16 Make una still give one goat as sin ofrin. Give dis plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
16 e um bode para oferta pelo pecado, além do holocausto contínuo com a sua oferta de cereais e a sua oferta de libação.
17 “ ‘For di sekond day, make una give twelf yong melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
17 No segundo dia, doze novilhos, dois carneiros, catorze cordeiros de um ano, sem defeito;
18 Una go still give dia grain and wine ofrin with di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok.
18 e a sua oferta de cereais, e as suas ofertas de libação para os novilhos, para os carneiros e para os cordeiros, conforme o seu número, segundo a ordenança;
19 Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
19 e um bode para oferta pelo pecado, além do holocausto contínuo com a sua oferta de cereais e as suas ofertas de libação:
20 “ ‘For di third day, una go give eleven melu, two ram, fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay,
20 No terceiro dia, onze novilhos, dois carneiros, catorze cordeiros de um ano, sem defeito;
21 with dia grain and wine ofrin, di melu, di ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok.
21 e a sua oferta de cereais, e as suas ofertas de libação para os novilhos, para os carneiros e para os cordeiros, conforme o seu número, segundo a ordenança;
22 Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
22 e um bode para oferta pelo pecado, além do holocausto contínuo com a sua oferta de cereais e a sua oferta de libação.
23 “ ‘For di fourt day, make una give ten melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay,
23 No quarto dia, dez novilhos, dois carneiros, catorze cordeiros de um ano, sem defeito;
24 with dia grain and wine ofrin, di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok.
24 e a sua oferta de cereais, e as suas ofertas de libação para os novilhos, para os carneiros e para os cordeiros, conforme o seu número, segundo a ordenança;
25 Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
25 e um bode para oferta pelo pecado, além do holocausto contínuo com a sua oferta de cereais e a sua oferta de libação.
26 “ ‘For di fift day, make una give nine melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay,
26 No quinto dia, nove novilhos, dois carneiros, catorze cordeiros de um ano, sem defeito;
27 with dia grain and wine ofrin, di melu, di ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok.
27 e a sua oferta de cereais, e as suas ofertas de libação para os novilhos, para os carneiros e para os cordeiros, conforme o seu número, segundo a ordenança;
28 Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
28 e um bode para oferta pelo pecado, além do holocausto contínuo com a sua oferta de cereais e a sua oferta de libação.
29 “ ‘For di sixt day, make una give eight melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay,
29 No sexto dia, oito novilhos, dois carneiros, catorze cordeiros de um ano, sem defeito;
30 with dia grain and wine ofrin, di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok.
30 e a sua oferta de cereais, e as suas ofertas de libação para os novilhos, para os carneiros e para os cordeiros, conforme o seu número, segundo a ordenança;
31 Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
31 e um bode para oferta pelo pecado, além do holocausto contínuo com a sua oferta de cereais e a sua oferta de libação.
32 “ ‘For di sevent day, make una give seven melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay,
32 No sétimo dia, sete novilhos, dois carneiros, catorze cordeiros de um ano, sem defeito;
33 with dia grain and wine ofrin, di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok.
33 e a sua oferta de cereais, e as suas ofertas de libação para os novilhos, para os carneiros e para os cordeiros, conforme o seu número, segundo a ordenança;
34 Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
34 e um bode para oferta pelo pecado, além do holocausto contínuo com a sua oferta de cereais e a sua oferta de libação.
35 “ ‘For di eight day, make una gada woship and nor do any work.
35 No oitavo dia tereis assembléia solene; nenhum trabalho servil fareis;
36 Make una give food ofrin to God, di smell wey God like well-well: one yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay,
36 mas oferecereis um holocausto em oferta queimada de cheiro suave ao Senhor: um novilho, um carneiro, sete cordeiros de um ano, sem defeito;
37 with dia grain and wine ofrin, di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok.
37 e a sua oferta de cereais, e as suas ofertas de libação para o novilho, para o carneiro e para os cordeiros, conforme o seu número, segundo a ordenança;
38 Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
38 e um bode para oferta pelo pecado, além do holocausto contínuo com a sua oferta de cereais e a sua oferta de libação.
39 “ ‘Dis na di law for burnt, grain, wine and fellowship ofrin wey una go give God wen una dey do di feast. Dis ones join di ofrin wey una go give to fulfil di vow or as free will ofrin.’ ”
39 Oferecereis essas coisas ao Senhor nas vossas festas fixas, além dos vossos votos, e das vossas ofertas voluntárias, tanto para os vossos holocaustos, como para as vossas ofertas de cereais, as vossas ofertas de libações e os vossos sacrifícios de ofertas pacíficas.
40 So Moses tell Israel pipol evritin wey God kommand am.
40 Falou, pois, Moisés aos filhos de Israel, conforme tudo o que o Senhor lhe ordenara.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?