Números 19

PCM vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 God tell Moses and Aaron:
1 Disse mais o Senhor a Moisés e a Arão:
2 “Dis na my kommand: ‘Make una tell Israel pipol make dem bring red melu wey dey okay and wey dem neva use take work before.
2 Esta é uma prescrição da lei que o Senhor ordenou, dizendo: Dize aos filhos de Israel que vos tragam uma novilha vermelha, perfeita, sem defeito, que não tenha ainda levado jugo.
3 Dem must gi-am to Eleazar wey bi priest, so dat e go karry am komot from di kamp, den dem go kill-am for en present.
3 Entregá-la-eis a Eleazar, o sacerdote; este a tirará para fora do arraial, e será imolada diante dele.
4 Priest Eleazar go take some of di blood with en finger kon sprinkol am seven times evriday for front of di tent where dem for dey do meetin.
4 Eleazar, o sacerdote, tomará do sangue com o dedo e dele aspergirá para a frente da tenda da congregação sete vezes.
5 Di full animal, plus di skin, meat, blood and intestine, dem go burn am for di priest present.
5 À vista dele, será queimada a novilha; o couro, a carne, o sangue e o excremento, tudo se queimará.
6 Den di priest go take cedar wood, hyssop leaf and one red rope kon put dem for fire.
6 E o sacerdote, tomando pau de cedro, hissopo e estofo carmesim, os lançará no meio do fogo que queima a novilha.
7 Di priest go wosh en klot kon baf with wota, den e go fit enter di kamp, but di priest go dey unklean till evening.
7 Então, o sacerdote lavará as vestes, e banhará o seu corpo em água, e, depois, entrará no arraial, e será imundo até à tarde.
8 Di pesin wey burn di melu must wosh en klot with wota kon baf, but e go dey unklean till evening.
8 Também o que a queimou lavará as suas vestes com água, e em água banhará o seu corpo, e imundo será até à tarde.
9 Den di man wey dey klean, go kollect di melu ashes kon go keep dem for klean place for outside di kamp and Israel pipol go use dem take prepare di wota wey dem go take make pipol holy. Dem dey do dis sakrifice to remove sin.
9 Um homem limpo ajuntará a cinza da novilha e a depositará fora do arraial, num lugar limpo, e será ela guardada para a congregação dos filhos de Israel, para a água purificadora; é oferta pelo pecado.
10 Di man wey gada di ashes must wosh en klot, but e go dey unklean till evening. Dis law na forever both for Israel pipol and di strenjas wey dey stay with dem.
10 O que apanhou a cinza da novilha lavará as vestes e será imundo até à tarde; isto será por estatuto perpétuo aos filhos de Israel e ao estrangeiro que habita no meio deles.
11 “ ‘Anybody wey go tosh dead body go dey unklean for seven days.
11 Aquele que tocar em algum morto, cadáver de algum homem, imundo será sete dias.
12 E must use klean wota take klean ensef for di third and sevent day, den e go dey holy. But if e nor klean ensef for di third and sevent day, e nor go dey holy.
12 Ao terceiro dia e ao sétimo dia, se purificará com esta água e será limpo; mas, se ao terceiro dia e ao sétimo não se purificar, não será limpo.
13 Anybody wey tosh human being dead body and e nor klean ensef, don dirty Oga God temple. So make una drive dat pesin komot from Israel pipol, bikos dem nor klean am with di wota wey dem dey use klean pipol wey nor klean.
13 Todo aquele que tocar em algum morto, cadáver de algum homem, e não se purificar, contamina o tabernáculo do Senhor ; essa pessoa será eliminada de Israel; porque a água purificadora não foi aspergida sobre ele, imundo será; está nele ainda a sua imundícia.
14 “ ‘Na di law bi dis: “If anybody die for di tent, evribody wey dey di tent wen di pesin die or wey enter, go dey unklean for seven days.
14 Esta é a lei quando morrer algum homem em alguma tenda: todo aquele que entrar nessa tenda e todo aquele que nela estiver serão imundos sete dias.
15 And evry kontaina for di tent wey nor get kover, go dey unklean.”
15 Também todo vaso aberto, sobre que não houver tampa amarrada, será imundo.
16 Anybody wey tosh pesin wey dem kill with swod for war or anybody wey tosh dead body, human being bone or grave, go dey unklean for seven days.
16 Todo aquele que, no campo aberto, tocar em alguém que for morto pela espada, ou em outro morto, ou nos ossos de algum homem, ou numa sepultura será imundo sete dias.
17 “ ‘Pesin wey dey klean go take some of di ashes from di melu wey dem burn for sin kon put am for pot, den pour fresh wota inside.
17 Para o imundo, pois, tomarão da cinza da queima da oferta pelo pecado e sobre esta cinza porão água corrente, num vaso.
18 Den e go bring hyssop leaf, deep am for wota kon sprinkol am for di tent, evritin for inside; for di pipol wey dey der and for di pesin wey tosh dead body, pesin bone or grave.
18 Um homem limpo tomará hissopo, e o molhará naquela água, e a aspergirá sobre aquela tenda, e sobre todo utensílio, e sobre as pessoas que ali estiverem; como também sobre aquele que tocar nos ossos, ou em alguém que foi morto, ou que faleceu, ou numa sepultura.
19 For di third and sevent day, di pesin wey dey klean go sprinkol di wota for di unklean pesin body. For di sevent day, e go santify di man den di man go wosh en klot kon baf, den e go dey klean for evening.
19 O limpo aspergirá sobre o imundo ao terceiro e sétimo dias; purificá-lo-á ao sétimo dia; e aquele que era imundo lavará as suas vestes, e se banhará na água, e à tarde será limpo.
20 But di man wey nor dey klean or neva klean ensef, go remain unklean, bikos dem neva sprinkol di klean wota for en body. E don spoil Tabanako and dem must separate am from God pipol.
20 No entanto, quem estiver imundo e não se purificar, esse será eliminado do meio da congregação, porquanto contaminou o santuário do Senhor ; água purificadora sobre ele não foi aspergida; é imundo.
21 Una go obey dis law forever.
21 Isto lhes será por estatuto perpétuo; e o que aspergir a água purificadora lavará as suas vestes, e o que tocar a água purificadora será imundo até à tarde.
22 Anytin wey unklean pesin tosh, go dey unklean and any oda pesin wey go tosh am go dey unklean till evening too.’ ”
22 Tudo o que o imundo tocar também será imundo; e quem o tocar será imundo até à tarde.

Ler em outra tradução

Comparar com outra