Números 18

PCM vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 God tell Aaron, “Yu, yor sons and yor tribe must sofa for di Tabanako sin; but only yu and yor sons go sofa for di priest sins.
1 Disse o Senhor a Arão: Tu, e teus filhos, e a casa de teu pai contigo levareis sobre vós a iniquidade relativamente ao santuário; tu e teus filhos contigo levareis sobre vós a iniquidade relativamente ao vosso sacerdócio.
2 Make yu karry yor brodas, Levi tribe and yor papa tribe follow body, so dat dem go join and help yu wen yu and yor sons dey for di tent.
2 Também farás chegar contigo a teus irmãos, a tribo de Levi, a tribo de teu pai, para que se ajuntem a ti e te sirvam, quando tu e teus filhos contigo estiverdes perante a tenda do Testemunho.
3 Dem must kare for yu and di whole Tabanako. But dem must nor kom near di holy tins for di Holy Place and di altar or all of una go die.
3 Farão o serviço que lhes é devido para contigo e para com a tenda; porém não se aproximarão dos utensílios do santuário, nem do altar, para que não morram, nem eles, nem vós.
4 Dem must work with yu kon kare for di tent where dem for dey do meetin and for all di work wey dey di tent, but anybody wey nor kwalifai, make e nor work with yu.
4 Ajuntar-se-ão a ti e farão todo o serviço da tenda da congregação; o estranho, porém, não se chegará a vós outros.
5 “Na yu go kare for di sanctuary and di altar, so dat problem nor go follow Israel pipol again.
5 Vós, pois, fareis o serviço do santuário e o do altar, para que não haja outra vez ira contra os filhos de Israel.
6 Even mi mysef don choose yor brodas; Levi pipol for Israel. God give dem to yu as gift wey go do di work for di tent where dem for dey meet.
6 Eu, eis que tomei vossos irmãos, os levitas, do meio dos filhos de Israel; são dados a vós outros para o Senhor , para servir na tenda da congregação.
7 But na yu and yor sons go do di priest work, evritin wey dey di altar and di Holy Place. And yu must work, bikos I don give yu di gift to bi priest and anybody wey I nor choose, if e kom near di holy tin, dem must kill-am.”
7 Mas tu e teus filhos contigo atendereis ao vosso sacerdócio em tudo concernente ao altar, e ao que estiver para dentro do véu, isto é vosso serviço; eu vos tenho entregue o vosso sacerdócio por ofício como dádiva; porém o estranho que se aproximar morrerá.
8 God kon tell Aaron, “Si, I don put yu to kare for my special ofrin; I don give yu all di holy tins wey Israel pipol give mi as yu and yor sons own forever.
8 Disse mais o Senhor a Arão: Eis que eu te dei o que foi separado das minhas ofertas, com todas as coisas consagradas dos filhos de Israel; dei-as por direito perpétuo como porção a ti e a teus filhos.
9 Out of all di ofrin wey holy well-well wey dem nor put for fire, dis go bi yor own: evry ofrin wey bi dia own, weda na from dia korn ofrin or from dia klean ofrin, or evry ofrin wey dem give mi, go dey holy well-well for yu and yor sons.
9 Isto terás das coisas santíssimas, não dadas ao fogo: todas as suas ofertas, com todas as suas ofertas de manjares, e com todas as suas ofertas pelo pecado, e com todas as suas ofertas pela culpa, que me apresentarem, serão coisas santíssimas para ti e para teus filhos.
10 Yu must chop am for di Most Holy Place and evry boy pikin fit chop am, bikos e go dey holy to yu.
10 No lugar santíssimo, o comerás; todo homem o comerá; ser-te-á santo.
11 “And dis na yor own: special ofrin wey kom from dia gift, togeda with all di peace ofrin wey Israel pipol give. I don give dem to yu and yor shidren forever. Evribody wey dey klean for yor family, go fit chop am.
11 Também isto será teu: a oferta das suas dádivas com todas as ofertas movidas dos filhos de Israel; a ti, a teus filhos e a tuas filhas contigo, dei-as por direito perpétuo; todo o que estiver limpo na tua casa as comerá.
12 “I dey give yu all di best olive oil, wine, wheat and di first fruit wey Israel pipol give God.
12 Todo o melhor do azeite, do mosto e dos cereais, as suas primícias que derem ao Senhor , dei-as a ti.
13 And any first fruit wey ripe for dia land wey dem give God, go bi yor own. Evribody wey dey klean for yor family go fit chop am.
13 Os primeiros frutos de tudo que houver na terra, que trouxerem ao Senhor , serão teus; todo o que estiver limpo na tua casa os comerá.
14 “Anytin for Israel wey dem give to God, go bi yor own.
14 Toda coisa consagrada irremissivelmente em Israel será tua.
15 Di first-born wey dem give to God, weda na human being or animal, go bi yor own. But di first-born for pipol and di first-born from man animal wey nor dey klean, dem must replace am.
15 Todo o que abrir a madre, de todo ser vivente, que trouxerem ao Senhor , tanto de homens como de animais, será teu; porém os primogênitos dos homens resgatarás; também os primogênitos dos animais imundos resgatarás.
16 Dem go take di shidren back wen dem don rish one mont kon pay five shekel for silva akordin to di sanctuary shekel.
16 O resgate, pois (desde a idade de um mês os resgatarás), será segundo a tua avaliação, por cinco siclos de dinheiro, segundo o siclo do santuário, que é de vinte geras.
17 “But make yu nor take money for di first-born for melu, sheep or goat, bikos dem dey holy. Yu must kill and sprinkol dia blood for di altar kon burn dia fat for di ofrin wey dem make with fire wey get betta smell to God.
17 Mas o primogênito do gado, ou primogênito de ovelhas, ou primogênito de cabra não resgatarás; são santos; o seu sangue aspergirás sobre o altar e a sua gordura queimarás em oferta queimada de aroma agradável ao Senhor .
18 But dia meat go bi yor own, just as di breast and di rite leg bi yor own.
18 A carne deles será tua, assim como será teu o peito movido e a coxa direita.
19 All di special ofrin for di tins wey dey holy wey Israel pipol give to God, I don give dem to yu and yor shidren forever. E go bi salt kovenant forever to God and na for yu and yor shidren-shidren.”
19 Todas as ofertas sagradas, que os filhos de Israel oferecerem ao Senhor , dei-as a ti, e a teus filhos, e a tuas filhas contigo, por direito perpétuo; aliança perpétua de sal perante o Senhor é esta, para ti e para tua descendência contigo.
20 God tell Aaron, “Yu nor get any propaty for dia land and know part for Israel land go bi yor own. Na mi God, bi evritin wey yu nid.
20 Disse também o Senhor a Arão: Na sua terra, herança nenhuma terás e, no meio deles, nenhuma porção terás. Eu sou a tua porção e a tua herança no meio dos filhos de Israel.
21 “I don give Levi pipol all di tithes wey Israel pipol give mi. Dis na to pay dem for dia work wey bi to kare for di tent where dem for dey do meetin.
21 Aos filhos de Levi dei todos os dízimos em Israel por herança, pelo serviço que prestam, serviço da tenda da congregação.
22 Di oda Israel pipol nor go kom near di tent where dem for dey do meetin again, or dem go bear dia sin and dem go die.
22 E nunca mais os filhos de Israel se chegarão à tenda da congregação, para que não levem sobre si o pecado e morram.
23 But Levi pipol must do di work for di tent where dem for dey do meetin and dem must bear dia own sin. Dis na rule forever for all Levi pipol. Levi pipol nor go get any propaty for Israel,
23 Mas os levitas farão o serviço da tenda da congregação e responderão por suas faltas; estatuto perpétuo é este para todas as vossas gerações. E não terão eles nenhuma herança no meio dos filhos de Israel.
24 bikos I don give dem di tithes wey Israel pipol give mi. Dat na why I sey dem nor go get any propaty for Israel.”
24 Porque os dízimos dos filhos de Israel, que apresentam ao Senhor em oferta, dei-os por herança aos levitas; porquanto eu lhes disse: No meio dos filhos de Israel, nenhuma herança tereis.
25 God kommand Moses:
25 Disse o Senhor a Moisés:
26 “Make yu go tell Levi pipol sey: ‘Wen una don kollect Israel pipol tithes wey God don give una as una own, una must divide am into ten kon give one part as special ofrin to God.
26 Também falarás aos levitas e lhes dirás: Quando receberdes os dízimos da parte dos filhos de Israel, que vos dei por vossa herança, deles apresentareis uma oferta ao Senhor : o dízimo dos dízimos.
27 Den God go kollect una special ofrin as E take kollect farmer own for new korn and wine.
27 Atribuir-se-vos-á a vossa oferta como se fosse cereal da eira e plenitude do lagar.
28 God special ofrin and tithes wey una kollect from Israel pipol, una go give dem to Priest Aaron.
28 Assim, também apresentareis ao Senhor uma oferta de todos os vossos dízimos que receberdes dos filhos de Israel e deles dareis a oferta do Senhor a Arão, o sacerdote.
29 From all una gifts, una must give di special ofrin wey bi God own and e must bi di best and e go dey holy.’
29 De todas as vossas dádivas apresentareis toda oferta do Senhor : do melhor delas, a parte que lhe é sagrada.
30 “So make yu Moses tell dem, ‘Wen una don give di best, una fit keep di rest, just as farmer dey keep wetin remain afta e don give en ofrin.
30 Portanto, lhes dirás: Quando oferecerdes o melhor que há nos dízimos, o restante destes, como se fosse produto da eira e produto do lagar, se contará aos levitas.
31 Una fit chop am for anywhere; both una and una family, bikos na una salari for una work for di tent where dem for dey do meetin, bi dat.
31 Comê-lo-eis em todo lugar, vós e a vossa casa, porque é vossa recompensa pelo vosso serviço na tenda da congregação.
32 And una nor go kommit any sin, since na di best part una give. Una must dey kareful, so dat una nor go trit di holy tins wey Israel pipol get, anyhow, bikos if una do am, una go die.’ ”
32 Pelo que não levareis sobre vós o pecado, quando deles oferecerdes o melhor; e não profanareis as coisas sagradas dos filhos de Israel, para que não morrais.

Ler em outra tradução

Comparar com outra