Números 11
PCM vs NVT
1 Di pipol kon dey komplain to God about dia problem. Wen God hear dem, E vex, so E send fire kom from heaven kon burn and distroy some part for di kamp.
1 O povo começou a reclamar de sua situação ao S enhor , que ouviu tudo que diziam. Então a ira do S enhor se acendeu, e ele enviou fogo que ardeu entre o povo, devorando alguns que viviam nas extremidades do acampamento.
2 Di pipol kry go meet Moses make e help dem; so Moses pray to God and di fire kon stop.
2 O povo gritou, pedindo ajuda a Moisés, e quando ele orou ao S enhor , o fogo se apagou.
3 So dem kon koll dat place “Taberah” bikos na for der God fire take burn di pipol.
3 Depois disso, aquele lugar foi chamado de Taberá, pois o fogo do S enhor ardeu ali entre eles.
4 Some yeye pipol wey travel with Israel pipol, get long-trot for meat and dem kon make Israel pipol dey komplain sey: “How wi wish sey wi fit just get some meat chop!
4 Então o bando de estrangeiros que viajava com os israelitas começou a desejar intensamente a comida do Egito. E o povo de Israel também começou a se queixar: “Ah, se tivéssemos carne para comer!
5 Wen wi dey for Egypt, wi dey chop any fish wey wi wont for free. Remember di cucumber, wotamelon, leeks, onions and di garlic dem wey wi dey chop.
5 Que saudade dos peixes que comíamos de graça no Egito! Também tínhamos pepinos, melões, alhos-porós, cebolas e alhos à vontade.
6 But naw, wi don dry finish. Nor-tin dey to chop, unless dis manna wey wi dey chop evriday!”
6 Mas, agora, perdemos o apetite. Não vemos outra coisa além desse maná!”.
7 (Manna bi like small-small seed wey en kolour na lite yellow.
7 O maná era como semente de coentro e tinha aparência de resina.
8 Di pipol go-go gada am for groun kon grind or pound am for mortar; den dem go take am bake kake. Di kake dey taste like fresh olive oil.
8 O povo saía e o recolhia do chão. Usava-o para fazer farinha, triturando-o em moinhos manuais ou socando-o em pilões. Depois, cozinhava o maná numa panela e fazia bolos achatados, que tinham gosto de massa folheada assada com azeite.
9 And wen di dew dey fall for nite, di manna dey kom with am.)
9 O maná caía sobre o acampamento durante a noite, com o orvalho.
10 Moses hear kry for evry family among di pipol; evribody dey for dia tent door-mot; so Moses nor dey happy, bikos God dey vex with dem.
10 Moisés ouviu todas as famílias reclamando à entrada de suas tendas, e a ira do S enhor se acendeu. Com isso, Moisés se revoltou
11 So Moses tell God, “Why Yu dey trit mi like dis? Why Yu sey make I kare for dis pipol?
11 e disse ao S enhor : “Por que tratas a mim, teu servo, com tanta crueldade? Tem misericórdia de mim! O que fiz para merecer o peso de todo este povo?
12 Nor bi mi kreate or born dem o-o! Why Yu go tell mi sey make I kare and karry dem for my hand like sey dem bi small pikin? Na so I go take karry dem go rish di land wey Yu promise dia grand-grand papa?
12 Por acaso gerei ou dei à luz este povo? Por que me pedes para carregá-lo nos braços como a mãe carrega o bebê que mama? Como o levarei à terra que juraste dar a seus antepassados?
13 Na where I go for get meat for all dis pipol, bikos dem dey kry give mi sey, ‘Make yu give us meat make wi chop?’
13 Onde conseguirei carne para todo este povo? Eles vêm a mim reclamando dizendo: ‘Dê-nos carne para comer!’.
14 I nor go fit karry all dis pipol by mysef! Di load two heavy for only mi!
14 Sozinho, não sou capaz de carregar todo este povo! O peso é grande demais!
15 E betta sey make Yu kill mi, dan sey make Yu dey trit mi like dis. If really sey Yu dey good to mi, den make Yu allow dis trobol pass mi.”
15 Se é assim que pretendes me tratar, mata-me de uma vez; para mim seria um favor, pois eu não veria esta calamidade!”.
16 God ansa Moses, “Make yu gada seventy men among di eldas for Israel wey yu know sey bi leaders among di pipol, den bring dem kom di Tabanako with yu.
16 Então o S enhor disse a Moisés: “Reúna diante de mim setenta homens reconhecidos como autoridades e líderes de Israel. Leve-os à tenda do encontro, para que permaneçam ali com você.
17 I go kom down kon tok with yu, I go take some of di Spirit wey dey inside yu kon put am inside dem and dem go help yu karry some of di wahala so dat yu nor go karry am on yor own.
17 Eu descerei e falarei com você. Tomarei um pouco do Espírito que está sobre você e o colocarei sobre eles. Assim, dividirão com você o peso do povo, para que não precise carregá-lo sozinho.
18 “Make yu tell di pipol make dem klean demsef, bikos dem go get meat to chop tumoro. God don hear una komplain and kry for meat and as una dey sey, ‘Wi dey okay for Egypt before!’ Naw, God go give una meat chop.
18 “Diga ao povo: ‘Consagrem-se, pois amanhã terão carne para comer. Vocês reclamaram e o S enhor os ouviu quando disseram: ‘Ah, se tivéssemos carne para comer! Estávamos melhor no Egito!’. Agora o S enhor lhes dará carne, e vocês terão de comê-la.
19 Una go chop am, nor bi only for one day or two; or five, ten or twenty days,
19 E não será apenas um dia, ou dois, ou cinco, ou dez ou mesmo vinte.
20 but na for one full mont. Una go chop am until meat go kom out from una nose kon make una dey sick, bikos una rijet God wey dey among una kon dey komplain sey, ‘Wi nor for komot from Egypt o-o.’ ”
20 Comerão carne por um mês inteiro, até lhes sair pelo nariz e vocês enjoarem dela, pois rejeitaram o S enhor que está aqui entre vocês e reclamaram contra ele, dizendo: ‘Por que saímos do Egito?’’”.
21 But Moses ansa God, “I get 600,000, sojas with mi and Yu still dey sey, ‘I go give dem meat for one full mont!’
21 Moisés, porém, respondeu ao S enhor : “Tenho comigo um exército de seiscentos mil soldados e, no entanto, dizes: ‘Eu lhes darei carne durante um mês inteiro!’.
22 Even if wi kill all awa animals, dem go rish us chop? Even if wi katch all di fish wey dey di sea, e go rish di pipol?”
22 Mesmo que abatêssemos todos os nossos rebanhos, bastaria para satisfazê-los? Mesmo que pegássemos todos os peixes do mar, seria suficiente?”.
23 Den God ansa, “So yu tink sey God hand short well-well? Naw, yu go si weda my word go happen or not!”
23 Então o S enhor disse a Moisés: “Você duvida do meu poder? Agora você verá se minha palavra se cumprirá ou não!”.
24 So Moses komot go tell di pipol wetin God tok. E kon pick seventy men wey bi leaders for Israel wey go follow am stand for di Tabanako.
24 Moisés saiu e transmitiu as palavras do S enhor ao povo. Reuniu os setenta líderes e os colocou ao redor da tenda da reunião.
25 God kom down for di kloud kon tok to dem. E take some of di Spirit wey dey inside Moses kon put dem inside di seventy men. Wen di Spirit enter dem, dem kon dey profesai, but dem nor do like dat again.
25 O S enhor desceu na nuvem e falou com ele. Depois, deu aos setenta líderes o mesmo Espírito que estava sobre Moisés. E, quando o Espírito pousou sobre eles, os líderes profetizaram, algo que nunca mais aconteceu.
26 Two out of di seventy men, Eldad and Medad kon stay for di kamp and dem nor go where di Tabanako dey. But di Spirit enter dem for where dem dey and dem kon start to profesai too.
26 Dois homens, Eldade e Medade, haviam permanecido no acampamento. Faziam parte da lista de autoridades, mas não tinham ido à tenda da reunião. E, no entanto, o Espírito também pousou sobre eles, de modo que profetizaram ali no acampamento.
27 One yong man run go tell Moses wetin Eldad and Medad dey do.
27 Um rapaz correu e contou a Moisés: “Eldade e Medade estão profetizando no acampamento!”.
28 Den Joshua wey Nun born, wey dey help Moses since e dey yong kon tell Moses sey, “My oga, make yu stop dem!”
28 Josué, filho de Num, que desde jovem era auxiliar de Moisés, protestou: “Moisés, meu senhor, faça-os parar!”.
29 Moses ansa, “Yu dey jealous? I for wish sey God give en Spirit to all en pipol, so dat all of dem go dey profesai!”
29 Moisés, porém, respondeu: “Você está com ciúmes por mim? Que bom seria se todos do povo do S enhor fossem profetas e se o S enhor colocasse seu Espírito sobre todos eles!”.
30 Den Moses and di seventy leaders kon go back to di kamp.
30 Então Moisés voltou ao acampamento com as autoridades de Israel.
31 Den God send breeze wey karry one kind bird wey dem dey koll kwail from di sea kom and dem fall kon high rish three fit for di groun. Dem dey evriwhere for di kamp, even for far-far place and for evry direcshon.
31 O S enhor mandou um vento que trouxe codornas do lado do mar e as fez voar baixo por todo o acampamento. Numa área de vários quilômetros em todas as direções, voavam a uma altura de quase um metro do chão.
32 So for dat day, for nite and di next day, di pipol kon dey gada di bird. Nobody gada less dan 1,000 kilogram. Dem spread dem round di kamp, so dat dem go dry.
32 O povo saiu e pegou codornas durante todo aquele dia, toda aquela noite e todo o dia seguinte. Ninguém recolheu menos de dez cestos grandes. Em seguida, espalharam as codornas por todo o acampamento para secá-las.
33 As dem still dey chop di meat, God kon dey vex with di pipol, so E send sickness go meet dem.
33 Mas, enquanto ainda se empanturravam, com a boca cheia de carne, a ira do S enhor se acendeu contra o povo, e ele os feriu com uma praga terrível.
34 So dem kon name dat place Kibrot Hattaavah (Long-trot Grave), bikos na der dem for beri di pipol wey dey ask of meat.
34 Por isso, aquele lugar foi chamado de Quibrote-Hataavá, pois ali sepultaram o povo que cobiçou a carne do Egito.
35 From der, di pipol travel go Hazerot kon kamp and stay der.
35 De Quibrote-Hataavá o povo viajou para Hazerote, onde ficou algum tempo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?