Números 10

PCM vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 God tell Moses:
1 O Senhor disse a Moisés:
2 “Make yu make two trumpet with silva from one hammer. Yu go use am take dey gada di kommunity and to tell dem wen dem won travel.
2 "Faça duas cornetas de prata batida a fim de usá-las para reunir a comunidade e para dar aos acampamentos o sinal para partirem.
3 Wen dem blow di two trumpet, all di kommunity must gada round yu for di tent where dem for dey do meetin door-mot.
3 Quando as duas cornetas tocarem, a comunidade inteira se reunirá diante de você, à entrada da Tenda do Encontro.
4 But if dem blow one, den di leaders and doz wey dey lead tazon go kom meet yu.
4 Se apenas uma tocar, os líderes, chefes dos clãs de Israel, se reunirão diante de você.
5 Wen yu blow alarm, di pipol wey dey di east side must start to travel.
5 Quando a corneta der um toque de alerta, as tribos acampadas a leste deverão partir.
6 Wen yu blow for di sekond time, di pipol wey dey di sout-side must start to travel.
6 Ao som do segundo toque, os acampamentos do lado sul partirão. O toque de alerta será o sinal para partir.
7 Yu must blow di trumpet wen yu gada di kommunity, but make yu nor sound alarm.
7 Para reunir a assembléia, faça soar as cornetas, mas não com o mesmo toque.
8 “Na only di priests wey bi Aaron shidren-shidren must blow di trumpet. Dis law na forever and una must obey am from one generashon go rish anoda.
8 "Os filhos de Arão, os sacerdotes, tocarão as cornetas. Este é um decreto perpétuo para vocês e para as suas gerações.
9 If una go fight against enemy wey dey attack una, den una must blow di alarm and di trumpet. Mi wey bi God go kon help and save una from una enemies.
9 Quando em sua terra vocês entrarem em guerra contra um adversário que os esteja oprimindo, toquem as cornetas; e o Senhor, o Deus de vocês se lembrará de vocês e os libertará dos seus inimigos.
10 And for di time wen una dey happy like di time for una festival or as di mont just dey start; una go blow di trumpet for una burnt ofrin and di sakrifice wey una dey do for peace ofrin, so dat God go dey remember una: Na mi bi di Oga una God.”
10 Também em seus dias festivos, nas festas fixas e no primeiro dia de cada mês, vocês deverão tocar as cornetas por ocasião dos seus holocaustos e das suas ofertas de comunhão, e elas serão um memorial em favor de vocês perante o seu Deus. Eu sou o Senhor, o Deus de vocês".
11 For di nomba twenty day, for di sekond mont, for di sekond year, afta di pipol don komot from Egypt, di kloud kon komot from di Tabanako for di Kovenant Box.
11 No vigésimo dia do segundo mês do segundo ano, a nuvem se levantou de cima do tabernáculo que guarda as tábuas da aliança.
12 So Israel pipol start to travel from Sinai Wildaness. Di kloud kon kom down for Paran Wildaness.
12 Então os israelitas partiram do deserto do Sinai e viajaram por etapas, até que a nuvem pousou no deserto de Parã.
13 Dis na di first time wen dem start to travel akordin to di kommand wey God give Moses.
13 Assim partiram pela primeira vez, conforme a ordem do Senhor anunciada por Moisés.
14 Just as dem take dey travel before, na so dem still dey do am. Judah tribe travel first akordin to dia family and na Nahshon wey Amminadab born dey lead dem.
14 Os exércitos do acampamento de Judá partiram primeiro, junto à sua bandeira. Naassom, filho de Aminadabe, estava no comando.
15 Netanel wey Zuar born, na-im dey lead Issakar tribe.
15 Natanael, filho de Zuar, comandava os exércitos da tribo de Issacar,
16 Na Eliab wey bi Helon pikin dey lead Zebulun pipol.
16 e Eliabe, filho de Helom, chefiava os exércitos da tribo de Zebulom.
17 Den dem karry di Tabanako go down and Gershon and Merari shidren kon karry di Tabanako as dem kontinue dia journey.
17 Quando o tabernáculo era desmontado, os gersonitas e os meraritas o carregavam e partiam.
18 Di next tribe wey follow na Reuben pipol and dem kon dey waka with dia flag. Na Elizur wey Shedeur born dey lead dem.
18 Os exércitos do acampamento de Rúben partiram em seguida, junto à sua bandeira. Elizur, filho de Sedeur, estava no comando.
19 Shelumiel wey Zurishaddai born, na-im dey lead Simeon pipol.
19 Selumiel, filho de Zurisadai, comandava os exércitos da tribo de Simeão,
20 Den Eliasaf wey bi Deuel pikin kon dey lead Gad pipol.
20 e Eliasafe, filho de Deuel, chefiava os exércitos da tribo de Gade.
21 Kohat pipol waka go karry di tins for di sanctuary and before dem go rish der, dem must don karry di Tabanako up.
21 Então os coatitas partiam carregando as coisas sagradas. Antes que eles chegassem, o tabernáculo já deveria estar armado.
22 Di next tribe na Efraim pipol wey dey waka with dia flag, akordin to dia family and na Elishama wey Ammihud born dey lead dem.
22 Os exércitos do acampamento de Efraim partiram em seguida, junto à sua bandeira. Elisama, filho de Amiúde, estava no comando.
23 Gamaliel wey Pedahzur bi en papa, na-im dey lead Manasseh tribe
23 Gamaliel, filho de Pedazur, comandava os exércitos da tribo de Manassés,
24 and Abidan wey Gideoni born dey lead Benjamin tribe.
24 e Abidã, filho de Gideoni, os exércitos da tribo de Benjamim.
25 Doz wey dey Dan tribe dey waka with dia flag, na dem bi di rear guide wey dey work for all di kamp akordin to dia family; Na Ahiezer wey Ammishaddai born dey lead dem.
25 Finalmente, partiram os exércitos do acampamento de Dã, junto à sua bandeira, como retaguarda para todos os acampamentos. Aieser, filho de Amisadai, estava no comando.
26 Pagiel wey Okran born, na-im dey lead Asher pipol
26 Pagiel, filho de Ocrã, comandava os exércitos da tribo de Aser,
27 and Ahira wey en papa bi Enan dey lead Naftali tribe.
27 e Aira, filho de Enã, a divisão da tribo de Naftali.
28 Dis na di way Israel pipol take travel; family by family.
28 Essa era a ordem que os exércitos israelitas seguiam quando se punham em marcha.
29 Moses tell en wife broda Hobab wey en papa na Reuel wey kom from Midian sey, “Wi won start to travel go di place wey God don sey E go give us. E don promise to make Israel prosper, so make yu follow us and wi go trit yu well.”
29 Então Moisés disse a Hobabe, filho do midianita Reuel, sogro de Moisés: "Estamos partindo para o lugar sobre o qual o Senhor disse: ‘Eu o darei a vocês’. Venha conosco e lhe trataremos bem, pois o Senhor prometeu boas coisas para Israel".
30 But Hobab ansa, “I nor go follow una, instead I go-go my own land go meet my pipol.”
30 Ele respondeu: "Não, não irei; voltarei para a minha terra e para o meu povo".
31 Moses kon sey, “Make yu nor leave us, bikos na Yu know where wi go stay for inside di wildaness and na yu go bi awa eye.
31 Moisés, porém, disse: "Por favor, não nos deixe. Você sabe onde devemos acampar no deserto e pode ser o nosso guia.
32 If yu follow us, wi go share all di blessings wey God go give us, with yu.”
32 Se vier conosco, partilharemos com você todas as coisas boas que o Senhor nos der".
33 Wen di pipol don komot from Sinai, wey bi di holy mountin, dem kon travel for three days. God Kovenant Box dey with dem for dat three days wey dem travel so and dem kon dey find where dem go fit rest put small.
33 Então eles partiram do monte do Senhor e viajaram três dias. A arca da aliança do Senhor foi à frente deles durante aqueles três dias para encontrar um lugar para descansarem.
34 As dem dey travel, God kloud dey kover dem.
34 A nuvem do Senhor estava sobre eles de dia, sempre que partiam de um acampamento.
35 And wen dem karry di box dey travel, Moses go sey,
35 Sempre que a arca partia, Moisés dizia: "Levanta-te, ó Senhor! Sejam espalhados os teus inimigos e fujam de diante de ti os teus adversários".
36 And wen di box stop, Moses go sey,
36 Sempre que a arca parava, ele dizia: "Volta, ó Senhor, para os incontáveis milhares de Israel".

Ler em outra tradução

Comparar com outra