1 God tok to mi about di nashons.
2 Dis na wetin E tok about Egypt and King Neko sojas for Egypt, wey King Nebukadnezzar for Babilon win for Karkemish near Eufrates River for di fourt year wen Jehoiakim bi king for Judah.
3 Egypt offisa dey shaut,
4 Make una ready and klimb una horse!
5 But God ask, “Na wetin I dey si so?
6 Even di sojas wey sabi run well-well,
7 Who bi dis wey dey flow kom like River Nile;
8 Na Egypt dey flow like River Nile;
9 Make una kommand di shariot make dem go!
10 Na God wey dey mighty get today.
11 Egypt pipol! Make una go Gilead go find medicine,
12 Oda nashons don hear of una shame
13 Wen King Nebukadnezzar kom attack Egypt, God tell mi sey,
14 “Make yu shaut am for Egypt,
15 Wetin make una mighty god wey dem dey koll Apis, fall? Na God strike am.
16 Una sojas don fall! Dem dey tell each oda sey,
17 For der, dem go sey, ‘Make una give Egypt king new name,
18 Mi, God wey dey mighty, I bi king.
19 Egypt pipol, make una ready to go Babilon as slaves!
20 Egypt bi like fine melu,
21 Even di sojas wey dem hire lazy like small goat.
22 Wen Egypt pipol si dia enemies dey kom,
23 or klear tick forest.
24 Dem disgrace Egypt pipol
25 Israel God still sey, “I go ponish Amon; Tebes god; Egypt with en gods and kings. I go karry Egypt king with doz wey trust am
26 give King Nebukadnezzar and en sojas wey won kill dem. But afta, pipol go stay for Egypt again, as dem do before.
27 “So make my pipol, Israel nor fear!
28 I go kom meet and save una.