1 God sey,
2 Doz wey still dey alive, I go sorry
3 I go kom help dem, bikos I love Israel pipol well-well
4 I go build una again and una go take una sheke-sheke
5 Una go plant vineyard on-top Samaria hill again
6 Yes, di time dey kom wen doz wey dey guide di gate
7 God even sey,
8 Den I ansa, ‘I go bring dem back from nort kon
9 As I dey lead dem kom back, dem go dey kry,
10 All di nashon, make una hear wetin Oga God won tok,
11 God go free and save Israel pipol
12 Bikos of di gift wey God give dem wey bi;
13 Den di yong wimen go sing with joy,
14 I go give good food to dia priests
15 God sey,
16 But naw, dis na wetin God dey tok,
17 True-true, yu get hope about yor tumoro
18 I hear Israel pipol dey tok with pain sey,
19 Before, wi sin against Yu,
20 So God ansa,
21 So make una mark di road,
22 Pipol wey nor bilive, na wen una go stop to waste una time?
23 Israel God wey dey rule evribody sey,
24 Pipol go stay for Judah and all en towns;
25 Doz wey don taya, I go give dem wota drink
26 Den pipol go sey,
27 God sey, “Di time dey kom wen I go make pipol and animals full Israel and Judah land again.
28 And just as I make sure sey dem rut, pul, ova-trow, distroy and skata dem, na so too I go make sure sey dem plant and build dem back again.
29 “Wen dat time rish, pipol nor go sey, ‘Papa and mama chop grape wey nor ripe, but na dia shidren tit dey pain dem.’
30 Instead, di pesin wey chop grape wey nor ripe, na en own tit go dey pain am and e go die bikos of en own sin.”
31 God sey, “Di time dey kom wen I go make new kovenant with Israel and Judah pipol.
32 E nor go bi like di old kovenant wey I make with dia grand-grand papa, wen I karry dem komot from Egypt. Even doh I bi like dia husband, dem nor gri keep di kovenant wey wi make.
33 Afta I don bring Israel pipol kom back to dia land, dis na di new kovenant wey I go make with dem: I go put and rite my law for dia heart. I go bi dia God and dem go bi my pipol.
34 “Pipol nor go nid to tish each oda about how to know God, bikos evribody go know mi; both doz wey poor and doz wey get money. I go forgive dia sins and I nor go remember di bad tins wey dem do before.
35 God don promise Israel pipol sey,
36 God promise sey,
37 Dis na wetin Oga God tok:
38 God sey, “Di time dey kom wen dem go ribuild evriwhere for Jerusalem wey bi my town; from Hananel Towa for west go rish Korna Gate.
39 And di boundary go kontinue from west go rish Gareb Hill kon turn go Goah.
40 All di valleys wey dem trow dead body and ashes put and all di field go rish Kidron Brook and di Horse Gate for east, go dey holy for God. Nobody go ever skata or distroy di town again.”