1 “E go bad well-well for doz leaders wey suppose kare for my pipol just as shepad dey kare for en sheep, but dem nor do am, instead dem distroy and skata my pipol.
2 Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok about di rulers wey suppose kare for en pipol: Bikos una nor kare for my pipol and una skata and drive dem komot, I go ponish una for di wiked tins wey una do.
3 I go gada my pipol wey remain from di kountry where I skata dem put kon bring dem kom back to dia land. Dem go get many shidren kon prosper for evritin and for evry side.
4 I go choose rulers wey go kare for dem. My pipol nor go fear at-all and I nor go ponish dem again.
5 God sey, “Di time dey kom
6 Wen e bikom king, Judah pipol go dey save
7 God sey, “Di time dey kom, wen pipol nor go use my name take swear sey, ‘Yu bi God wey dey alive wey take Israel pipol komot from Egypt.’
8 Instead dem go sey, ‘Yu bi di God wey dey alive wey bring Israel pipol kom back from di land for nort and from di oda kountries wey Yu skata dem go.’ For dat time, dem go dey dia own land.”
9 Dis na wetin God tok about lie-lie profets:
10 Na pipol wey nor dey faithful,
11 God sey,
12 So di road wey dem dey pass,
13 God sey,
14 But I si sey na Jerusalem profets own worse pass;
15 So, dis na wetin mi wey bi God dey tok
16 God wey dey mighty still tell Jerusalem pipol:
17 Pipol wey nor gri listin to wetin God tok,
18 So, I sey, Nobody among dis profets
19 But just look, God vexnashon go kom like heavy breeze
20 E nor go end until E don do evritin wey E plan to do.
21 God sey,
22 How I wish dem know wetin I dey tink for my mind,
23 Abi una tink sey I bi God
24 E nor get where pesin go hide
25 “I know evritin wey doz profets tok; dem dey lie with my name sey I tok to dem thru dreams.
26 How long e go take for doz profets to stop to dey deceive my pipol with dia lie-lie word?
27 Dem tink sey di dream wey dem dey tok so, go make my pipol forget mi, just as dia grand-grand papa forget mi kon dey follow Baal?
28 Make di profet wey dream, tok only wetin e dream and make di profet wey hear my message, tok di trut. Nobody fit use tree kanda kompare di main tree.
29 My message bi like fire and na hammer wey dey break rock into pieces.
30 I hate all doz profets wey dey listin to oda profets words kon tell my pipol sey na mi tok am.
31 I still dey against doz profets wey dey tok dia own word kon sey na mi tell dem.
32 Make una listin to wetin mi wey bi God tok! I hate doz profets wey dey tok dia lie-lie dreams kon lead my pipol komot from di trut. I nor send dem and dem nor dey help my pipol at-all.
33 God tell mi, “Jeremaya, if anybody among my pipol, or profet or priest ask yu, ‘Wetin God tok?’ Make yu tell dem sey, ‘Una dey disturb God and E go distroy una.’
34 I go ponish anybody, profet or priest wey sey, ‘God message na wahala!’ I go ponish di pesin and all en family.”
35 So mi, Jeremaya dey tell una sey, “Make una dey ask una friend or relashon, ‘Wish ansa God give and wetin God tok?’
36 So make una nor sey God message na wahala, bikos if anybody tok like dat, den di message go bi wahala to am. Di pipol don shange dia God; di Almighty God wey dey alive, dem don shange en word.
37 So Jeremaya, ask di profets, ‘Wish ansa God give una or wetin God tok?’
38 But if dem nor obey my kommand kon sey, ‘God message na wahala,’ den yu go tell dem sey,
39 ‘God go trow una far from am; both una and di town wey E give una and una grand-grand papa.’
40 I go disgrace dem forever and dem nor go forget am.”