1 God tell mi, “Make yu go Judah king palis kon tell am dis message:
2 ‘Judah king wey sidan for David throne, en ofisas and all en pipol wey dey pass dis gate, make una listin.
3 Dis na wetin God tok: “Make una do wetin dey good and korrect. Make una protet pesin wey dem dey opress from who dey opress am. Make una nor trit or opress strenjas; doz wey nor get papa and mama or wimen wey dia husband don die and make una nor kill innocent pipol for dis land.
4 If una really do wetin I kommand, den David shidren-shidren go kontinue to bi king. Both dem, dia ofisas and dia pipol go kontinue to ride horse pass dis palis gate.
5 But I swear sey, if una nor obey my kommand, dem go distroy dis palis rish groun.
6 “Even doh Judah royal palis fine like Gilead land and Mount Lebanon,
7 I go send men kon distroy am.
8 Wen pipol from oda nashons dey pass,
9 Den, some go ansa,
10 “Judah pipol, make una nor kry and mourn
11 Dis na wetin God tok about Josaya wey bi Shallum pikin, wey take-ova from en papa as king, before dem karry am go Babilon. God sey, “E nor go ever kom back to dis land again.
12 E go die as slave for di kountry where dem dey karry am go and e nor go si dis land again.”
13 “E go bad for di king
14 E go bad for di king wey sey,
15 If yu take cedar wood build house
16 E judge poor pipol well
17 But yu dey always tink and look for ways
18 So, dis na wetin God tok about Josaya pikin,
19 Just as dem nor dey beri donkey wey die,
20 Jerusalem pipol, make una shaut and mourn
21 Wen una dey prosper and enjoy,
22 So breeze go blow una leaders trowey;
23 Una fit tink sey una dey save like bird
24 God sey, “As far as I bi di God wey dey alive, Jehoiakim pikin, Jekonaya wey bi king for Judah, yu nor go fit bi king for dis eart. I go take dat pawa komot from yor hand.
25 I go give yu to doz wey yu dey fear and wey won kill yu. I go give yu to King Nebukadnezzar for Babilon and en sojas.
26 I go force yu and yor mama wey born yu, go anoda kountry. Una go-go kountry where dem nor for born una and una go die for der.
27 Yu go like to kom back to dis kountry, but yu nor go ever kom back again.”
28 I sey, “King Jekonaya go bi like pot
29 Judah land, Judah land, Judah land!
30 God sey, “Make yu rite dis man name