1 God tell mi,
2 “Make yu go di house wey dem for dey make pot and I go tok to yu for der.”
3 So I go der kon si di man wey dey make pot wen e dey mold one pot.
4 But wen e si sey di tin wey e dey mold nor good as e wont, e skata am kon start again.
5 Den God tell mi,
6 “Israel pipol, I nor get rite to do una wetin di man wey dey mold pot dey do with di klay? Just as klay dey di pesin wey dey make pot hand, na so too una dey my hand.
7 If I sey I go rut, break or distroy any nashon or kingdom
8 and dat nashon stop to dey disobey mi, I nor go do wetin I bin sey I go do.
9 And if I sey I go plant or build any nashon or kingdom
10 and dat nashon disobey mi and do bad-bad tins, I nor go do wetin I sey I go do.
11 So naw, tell Judah and Jerusalem pipol sey, ‘I dey plan and dey ready to ponish dem.’ Tell dem make dem stop to dey sin kon shange di way dem dey live dia life and di tins wey dem dey do.
12 But dem go sey, ‘No! Wetin go make us shange? Wi go do anytin wey wi wont! Awa heart strong and wi go do all di wiked tins wey wi wont.’ ”
13 God still sey,
14 Snow dey finish on-top Lebanon rock?
15 But my pipol don forget mi,
16 Naw, di land go turn
17 I go distroy dem for dia enemies front
18 Den di pipol sey, “Make una kom, make wi do sometin about dis Jeremaya! Wi go always get priest wey go dey to tell us wetin wi go do; wise pipol go dey wey go advise us and wi go always get profet wey go prish God word give us. So make wi lie against am kon stop to listin to anytin wey e tok.”
19 So, I kon pray:
20 Na evil dem dey take pay good?
21 But naw, make honga kill dia shidren and make dem die for war. Make di wimen luz dia husband and shidren; make diziz kill di men and make di yong men die for war.
22 Make tif karry evritin wey dem get for dia house,
23 But my God, Yu know all dia plan to kill mi.