1 God sey,
2 Una shidren nor dey ever forget di altar
3 and for di mountin wey dey di open kountry.
4 Una go komot for di land wey I give una
5 God sey,
6 Dem go bi like bush for desert or for groun
7 But I go bless doz wey trust mi.
8 Dem go bi like tree wey dem plant for near river
9 Na wikedness full human being mind and e bad well-well.
10 Na mi wey bi God dey si
11 Pesin wey dey make money with wayo,
12 So I sey,
13 Na Yu bi di hope wey Israel get;
14 My God, make Yu heal mi and I go strong again;
15 Di pipol dey ask,
16 But my Oga,
17 Nor make mi fear Yu,
18 Pipol wey dey tok bad against mi,
19 God tell mi, “Make yu go stand for di gate wey Judah king dey pass komot from di town and enter back and yu go still go stand for all di oda gates wey dey for Jerusalem too.
20 Den tell di king; Judah pipol, doz wey dey stay for Jerusalem and evribody wey dey pass di gates sey, ‘Make una listin to wetin God tok.
21 God sey, “If una value una life well-well, for Sabat Day, make una nor karry any load pass di gates for Jerusalem
22 or bring anytin kom out from una house or do any work. But make una si am as holy day for God, just as I kommand and tell una grand-grand papa dem.
23 But una grand-grand papa nor listin to mi, bikos dem sturbon and nor gri obey or learn from mi.” ’
24 “God still sey, ‘Una must obey all wetin I kommand. Una must nor karry load pass di town gates for Sabat Day. Una must si Sabat as holy day and una nor go do any work for dat day.
25 If una do am, den di kings and di prince go enter Jerusalem gates kon get di same royal pawa wey David get. Dem with Judah and Jerusalem pipol go ride dia horse and Jerusalem town go always dey full with pipol.
26 Den pipol go kom from Judah town and from all di village wey dey round Jerusalem; from Benjamin town go rish di hill, mountins and from sout for Judah. Dem go bring burnt ofrin, sakrifice, korn ofrin, incense and tanksgivin ofrin kom my temple.
27 But una must obey mi kon make di Sabat, holy. For dat day, una must nor karry any load pass Jerusalem gate, if una do am, I go burn di gate rish round. Fire go burn di palis rish groun too and nobody go fit kwensh am.’ ”