1 For di year wen King Uzzaya die, I kon si vishon as God sidan for en throne wey get glory for heaven and en klot kover di temple.
2 Di kind creatures wey stand near am, dey bring out fire from dia mout and each of dem get six-six feada. Dem kover dia face with two feada; use two kover dia leg, den dem dey use di oda two take dey fly.
3 Each of dem dey sing dey sey,
4 Dia vois dey make di temple foundashon shake and smoke
5 I kon sey, “My own don finish, bikos evry word wey dey komot from my mout, na sin full am and I dey stay with pipol wey all dia words na sin and naw, I don use my eyes si Oga God wey bi di king wey get pawa.”
6 Den one of di creature fly kom meet mi for groun and e use big sizos take hold shako wey dey burn and na from di altar e for karry am kom.
7 E use di hot shako take tosh my lips kon sey, “Dis tin don tosh yor lip, so from naw, yu don dey klean, bikos God don forgive yu.”
8 Den I hear God ask, “Who I go send? Who go bi awa messenja?”
9 So E tell mi make I go give di pipol dis message:
10 Den E tell mi,
11 I kon ask, “Oga God, how long dis tins go take happen?”
12 I go send my pipol go far place
13 Even if na one pesin for evry ten pipol remain for di land,