1 Naw, I go sing to my love;
2 E build fence round di land kon remove di small-small stones
3 So, my love sey, “Jerusalem and Judah pipol,
4 E get anytin wey I nor do for dis vineyard?
5 Naw, make I tell una wetin I go do to my vineyard:
6 I go let grass grow for evriwhere
7 Na Israel pipol bi God vineyard,
8 Una own don finish!
9 God wey dey lead heaven sojas sey,
10 True-true, big vineyard go produce only five gallon of wine
11 Una own don finish! Una wey dey wake up for early morning bigin drink.
12 Yes! Una dey play harp, tamborin, flute
13 so dem go karry una komot una land
14 Deat go open en mout wide dey wait dem
15 Dem go disgrace evribody
16 Wen God wey dey lead heaven sojas don ponish dis pipol,
17 Plenty sheep and oda animals go kom
18 God go ponish pipol wey dey kause trobol with dia sins and lie-lie words;
19 Dem dey sey, “Make God kwik do wetin E sey E go do,
20 Una own don finish!
21 Pipol wey tink sey dem wise and get sense,
22 Una own don finish!
23 Dem dey free pipol wey dey guilty kon opress doz wey dey innocent,
24 So, as straw and dry grass dey burn for fire,
25 God dey vex for en pipol and E don ready to ponish dem.
26 God dey use sign take koll pipol from far-far nashon.
27 No one taya or stagga for road
28 Dem sharp dia arrow well and dia bows don ready to shot.
29 Di sojas dey shaut like lion wey kill animal
30 Wen dat day rish, di sojas wey dey kom from far, go make loud nois give Israel pipol;