1 Naw, di Oga God wey get pawa won remove evritin
2 strong men, sojas, judge, profets,
3 sojas oga, dia pipol, advisers
4 God sey, “I go make yong pipol rule dem
5 Dem go dey fight each oda;
6 Time dey kom wen pesin go hold en broda hand kon sey,
7 But e go ansa, “Nor bi mi, I nor fit help una.
8 Yes! Jerusalem pipol own don finish and Judah town don dey fall!
9 Dia face dey show sey dem dey guilty.
10 So make una tell innocent pipol sey e go betta for dem,
11 But evil pipol own don finish,
12 Wiked men dey opress my pipol and doz wey borrow dem money,
13 God don dey ready to judge.
14 God won judge doz wey dey lead en pipol.
15 Why una dey wahala my pipol and sofa doz wey nor get money?
16 God sey, “Si how Jerusalem wimen dey karry body up!
17 But I go ponish dem,
18 Di day dey kom wen God go kollect evritin wey dey make Jerusalem wimen dey make yanga; dat is, di ring wey dem dey wear for dia hand, head, neck
19 and dia waist. E go kollect dia klot,
20 dia priest kap, di majik wey dem wear for dia hands and waist;
21 di rings wey dem wear for dia fingers and nose;
22 all dia fine robes, gowns, koat, pus;
23 dia garments wey dey show dia body; dia handkachief, dia head-tie and di long klot wey dem dey wear for dia head.
24 Instead make dem dey scent well, dem go dey smell.
25 Di town men and doz wey strong well-well,
26 Den Zion pipol go sidan for groun dey kry and mourn,