1 Dis message na about Damaskus pipol,
2 Dem go abandon Siria town forever
3 Nobody or town go defend Israel land again
4 God sey, “For dat time,
5 E go bi like wen pesin gada rice
6 Na only few pipol go survive for Israel
7 Wen dat day rish, pipol go trust God wey kreate dem;
8 Dem nor go put dia hope for di altar
9 For dat time, dia strong town go skata
10 Israel pipol don forget di God wey save and protet dem like big rock.
11 True-true, di day una start to plant,
12 So all di strong nashons wey gada togeda nor betta pass pipol wey don die;
13 Even doh dis pipol dey make nois like heavy wave for sea,
14 For evening, dem go dey fear kon vanish