1 Dis na di message wey God give Isaya wey bi Amos pikin about Babilon.
2 Make yu go on-top di hill go raiz di war flag!
3 I don give orda to di sojas wey I choose,
4 Di mountin dey make nois like wen many sojas dey mash!
5 Dem kom from far-far kountry;
6 So make una kry with pain,
7 So bikos of dis, evry hand go weak
8 Fear go katch all of dem with pain like woman wey won born.
9 Si, di day wey God go judge us dey kom;
10 True-true, all di stars and oda tins wey dey shine,
11 God sey, “I go bring wahala kom di eart
12 Just as pure gold nor plenty,
13 For di day wey mi,
14 Di strenjas for Babilon go run go dia own land
15 Anybody wey dem katch,
16 Dem go kill dia own shidren for dia front;
17 God sey, “I go make Medes pipol attack Babilon pipol.
18 Dem go use dia bows and arrows kill di yong men and dem
19 Na Babilon pipol fine pass for all di kingdom
20 Nobody go stay der again.
21 Na wild animals go dey stay der
22 Hyenas and jackals go dey make nois for di towa and di palis,