1 For dat time, one pesin go kom from Jesse family.
2 God Spirit go dey with am.
3 E go always dey happy to obey God.
4 E go judge evribody akordin to wetin dem do
5 E go rule en pipol
6 Just as wolf and sheep wey nor dey gri but kon stay togeda for peace,
7 Melu and bear go chop togeda and dia pikin go liedan togeda with happiness.
8 Snake wey get poizin nor go bite small pikin,
9 So, great Zion, God hill wey dey holy,
10 Di day dey kom wen di new king from David family go bi sign to all di nashons. Pipol go gada for en royal town; gi-am respet kon ask make e guide dem.
11 Wen dat day rish, Israel pipol wey dey Assyria, Patros, Sudan, Elam, Babilon, Hamat, di towns wey dey near di sea and Egypt, God go use en pawa take bring dem kom back to Jerusalem.
12 God go raiz flag as sign for di pipol;
13 Efraim pipol nor go jealous Judah pipol and Judah pipol
14 Dem go attack Filistia pipol togeda for di west
15 God go divide Egypt pipol sea;
16 E go kreate one way wey en pipol wey remain go take komot for Assyria land,