Hebreus 12
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 Since wi get many witness wey surround us, e good make wi drop evry load and sin wey dey make us fall, so dat wi go use awa mind live di life wey God wont.
1 Portanto, nós também, pois, que estamos rodeados de uma tão grande nuvem de testemunhas, deixemos todo embaraço e o pecado que tão de perto nos rodeia e corramos, com paciência, a carreira que nos está proposta,
2 Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.
2 olhando para Jesus, autor e consumador da fé, o qual, pelo gozo que lhe estava proposto, suportou a cruz, desprezando a afronta, e assentou-se à destra do trono de Deus.
3 If una dey tink how Jesus sofa for wiked pipol hand and how dem hate am, una mind go strong for faith.
3 Considerai, pois, aquele que suportou tais contradições dos pecadores contra si mesmo, para que não enfraqueçais, desfalecendo em vossos ânimos.
4 As una dey struggol make una nor for sin, una struggol neva rish to kill una as Christ die.
4 Ainda não resististes até ao sangue, combatendo contra o pecado.
5 Abi una don forget di advise wey God tell una as en shidren?
5 E já vos esquecestes da exortação que argumenta convosco como filhos: Filho meu, não desprezes a correção do Senhor e não desmaies quando, por ele, fores repreendido;
6 Bikos na di pesin wey God love,
6 porque o Senhor corrige o que ama e açoita a qualquer que recebe por filho.
7 So make una bear as una dey sofa, since e bi sey na una Papa dey ponish una; dat one go show sey God dey trit una like en shidren. Abi e get pikin wey en papa nor dey ponish?
7 Se suportais a correção, Deus vos trata como filhos; porque que filho há a quem o pai não corrija?
8 But if God nor ponish yu as e dey ponish all en shidren, dat mean sey yu nor bi betta pikin and yu nor get papa.
8 Mas, se estais sem disciplina, da qual todos são feitos participantes, sois, então, bastardos e não filhos.
9 If awa papa for eart ponish us and wi dey respet dem, e nor good make God ponish us, so dat awa life go betta?
9 Além do que, tivemos nossos pais segundo a carne, para nos corrigirem, e nós os reverenciamos; não nos sujeitaremos muito mais ao Pai dos espíritos, para vivermos?
10 Awa papa dey ponish us for dis world as e good for dia eye, but God dey ponish us for awa own good, so dat wi go follow am share en holiness.
10 Porque aqueles, na verdade, por um pouco de tempo, nos corrigiam como bem lhes parecia; mas este, para nosso proveito, para sermos participantes da sua santidade.
11 No ponishment dey sweet pesin wen dem dey ponish am, bikos e dey pain. But di pesin wey God ponish, go get life wey nor dey end.
11 E, na verdade, toda correção, ao presente, não parece ser de gozo, senão de tristeza, mas, depois, produz um fruto pacífico de justiça nos exercitados por ela.
12 So una hands and knees wey don taya, make una make dem strong.
12 Portanto, tornai a levantar as mãos cansadas e os joelhos desconjuntados,
13 And make una waka for strait road, so dat una leg wey don taya, go strong.
13 e fazei veredas direitas para os vossos pés, para que o que manqueja se não desvie inteiramente; antes, seja sarado.
14 Make una try to live for peace with evribody and dey holy, bikos anybody wey nor dey holy, nor go si God.
14 Segui a paz com todos e a santificação, sem a qual ninguém verá o Senhor,
15 Make una make sure sey nobody turn back from God grace and make nobody get bad belle and kause trobol wey go make pipol sin.
15 tendo cuidado de que ninguém se prive da graça de Deus, e de que nenhuma raiz de amargura, brotando, vos perturbe, e por ela muitos se contaminem.
16 Make una make sure sey nobody dey do bad tins or nor dey fear God, just like Esau wey sell en rite as first-born, bikos of food.
16 E ninguém seja fornicador ou profano, como Esaú, que, por um manjar, vendeu o seu direito de primogenitura.
17 Una know how e try to get am back leta, but e nor fit, even doh e beg and kry give en papa.
17 Porque bem sabeis que, querendo ele ainda depois herdar a bênção, foi rejeitado, porque não achou lugar de arrependimento, ainda que, com lágrimas, o buscou.
18 Una don rish Mount Sinai, where God for tok to Israel pipol. For der, fire dey burn, darkness dey der and storm and
18 Porque não chegastes ao monte palpável, aceso em fogo, e à escuridão, e às trevas, e à tempestade,
19 trumpet kon dey make nois. Israel pipol hear God vois, so dem beg am make E stop,
19 e ao sonido da trombeta, e à voz das palavras, a qual, os que a ouviram pediram que se lhes não falasse mais;
20 bikos dem nor fit bear en kommand wey sey, “Make una kill any animal wey tosh di mountin.”
20 porque não podiam suportar o que se lhes mandava: Se até um animal tocar o monte, será apedrejado.
21 Wetin happen dey make pesin fear, so Moses kon sey, “I dey fear and dey shake.”
21 E tão terrível era a visão, que Moisés disse: Estou todo assombrado e tremendo.
22 Instead, una don kom Mount Zion; di town where God dey stay; di Jerusalem for heaven where tazon angels dey. Una don enter di assembly,
22 Mas chegastes ao monte Sião, e à cidade do Deus vivo, à Jerusalém celestial, e aos muitos milhares de anjos,
23 di place where all di first-born gada and dis na di pipol wey God rite dia name for heaven. Una don kom meet God wey go judge evribody and na-im dey make pipol pafet.
23 à universal assembleia e igreja dos primogênitos, que estão inscritos nos céus, e a Deus, o Juiz de todos, e aos espíritos dos justos aperfeiçoados;
24 Una don kom meet Jesus, di pesin wey God use take start di new kovenant with en pipol and una don kom meet di blood wey dem spray and dis blood dey tok betta word wey pass Abel own.
24 e a Jesus, o Mediador de uma nova aliança, e ao sangue da aspersão, que fala melhor do que o de Abel.
25 Make sure sey una dey obey di Pesin wey dey tok to una! Bikos if Israel pipol wey nor gri hear dia oga Moses word for eart nor eskape, how wi go fit eskape, if wi nor gri hear di Pesin wey dey tok to us from heaven?
25 Vede que não rejeiteis ao que fala; porque, se não escaparam aqueles que rejeitaram o que na terra os advertia, muito menos nós, se nos desviarmos daquele que é dos céus,
26 For dat time, en vois dey shake di eart, but naw, E don promise sey, “Nor bi only dis eart I go shake, but I go shake di heavens too.”
26 a voz do qual moveu, então, a terra, mas, agora, anunciou, dizendo: Ainda uma vez comoverei, não só a terra, senão também o céu.
27 Dis mean sey di tins for eart go shake komot and na only di tins wey God nor won shake, go remain.
27 E esta palavra: Ainda uma vez, mostra a mudança das coisas móveis, como coisas feitas, para que as imóveis permaneçam.
28 Since wi don receive di kingdom wey dem nor fit skata, make wi tank and woship God with respet and fear. Make wi gi-am di kind woship wey go make belle sweet am.
28 Pelo que, tendo recebido um Reino que não pode ser abalado, retenhamos a graça, pela qual sirvamos a Deus agradavelmente com reverência e piedade;
29 Bikos awa God na big and strong fire wey dey distroy tins.
29 porque o nosso Deus é um fogo consumidor.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Hebreus 12, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.