Gênesis 19
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 Di two angels kon rish Sodom for evening and dat time, Lot sidan for di town gate. Wen Lot si dem, e get up go meet dem kon bow face groun.
1 Ao anoitecer, vieram os dois anjos a Sodoma, a cuja entrada estava Ló assentado; este, quando os viu, levantou-se e, indo ao seu encontro, prostrou-se, rosto em terra.
2 E kon sey, “Una my oga! Abeg, make una kom enter una savant house. Make una wosh una legs and na here una go sleep dis nite. Den tumoro morning, una fit kontinue una journey.”
2 E disse-lhes: Eis agora, meus senhores, vinde para a casa do vosso servo, pernoitai nela e lavai os pés; levantar-vos-eis de madrugada e seguireis o vosso caminho. Responderam eles: Não; passaremos a noite na praça.
3 Lot beg dem well-well, so dem kon enter en house. E kommand en savant make e bake bread without yist for dem and dem kon chop.
3 Instou-lhes muito, e foram e entraram em casa dele; deu-lhes um banquete, fez assar uns pães asmos, e eles comeram.
4 Before di angels go bed dat nite, Sodom men kon surround di house. All di men for di town, both yong and old gada for der.
4 Mas, antes que se deitassem, os homens daquela cidade cercaram a casa, os homens de Sodoma, tanto os moços como os velhos, sim, todo o povo de todos os lados;
5 Di men kon koll Lot dey sey, “Where di men wey kom meet yu dis evening? Bring dem kom out, so dat wi go sleep with dem!”
5 e chamaram por Ló e lhe disseram: Onde estão os homens que, à noitinha, entraram em tua casa? Traze-os fora a nós para que abusemos deles.
6 Lot go meet dem for outside kon klose di door.
6 Saiu-lhes, então, Ló à porta, fechou-a após si
7 E kon ansa, “No my brodas! Make una nor do dis wiked tin!
7 e lhes disse: Rogo-vos, meus irmãos, que não façais mal;
8 Si, I get two dotas wey neva sleep with man before. Make I give dem to una and una if do dem anytin wey una like. But make una nor do anytin to dis men, bikos na my house dem dey.”
8 tenho duas filhas, virgens, eu vo-las trarei; tratai-as como vos parecer, porém nada façais a estes homens, porquanto se acham sob a proteção de meu teto.
9 Dem kon shaut gi-am sey, “Komot for awa front, yu wey bi strenja for dis place; na yu won tell us wetin wi go do! Wetin wi go do yu go worse pass wetin wi go do dem.”
9 Eles, porém, disseram: Retira-te daí. E acrescentaram: Só ele é estrangeiro, veio morar entre nós e pretende ser juiz em tudo? A ti, pois, faremos pior do que a eles. E arremessaram-se contra o homem, contra Ló, e se chegaram para arrombar a porta.
10 But di angels inside Lot house open di door draw Lot enter inside kon klose am.
10 Porém os homens, estendendo a mão, fizeram entrar Ló e fecharam a porta;
11 Di angel kon make di pipol eye blind; from di yong ones go rish di old ones. Den di men for outside kon dey find di door.
11 e feriram de cegueira aos que estavam fora, desde o menor até ao maior, de modo que se cansaram à procura da porta.
12 So di two angels kon tell Lot, “Yu still get anybody for dis town? Yor pikin husband dem dey di town? Abi yu get any broda or sista for here? Go tell dem make dem komot from dis town,
12 Então, disseram os homens a Ló: Tens aqui alguém mais dos teus? Genro, e teus filhos, e tuas filhas, todos quantos tens na cidade, faze-os sair deste lugar;
13 bikos wi kom distroy di town. Dia sin and di wiked tins wey dem dey do, don too many. So God send us kom distroy am.”
13 pois vamos destruir este lugar, porque o seu clamor se tem aumentado, chegando até à presença do Senhor ; e o Senhor nos enviou a destruí-lo.
14 Den Lot go tell di men wey won marry en dotas sey, “Make una kwik-kwik komot from dis town, bikos God won distroy am!” But dem tink sey Lot dey lie for dem.
14 Então, saiu Ló e falou a seus genros, aos que estavam para casar com suas filhas e disse: Levantai-vos, saí deste lugar, porque o Senhor há de destruir a cidade. Acharam, porém, que ele gracejava com eles.
15 For morning, di angel kon tell Lot, “Make una dey go! Lot! Karry yor wife and shidren komot kwik-kwik, if not, wen God dey judge di town, dem go distroy una join!”
15 Ao amanhecer, apertaram os anjos com Ló, dizendo: Levanta-te, toma tua mulher e tuas duas filhas, que aqui se encontram, para que não pereças no castigo da cidade.
16 Wen Lot still dey slow, di angels kon drag en, en wife and en shidren komot di town, bikos God like Lot. Dem drop dem for outside di town.
16 Como, porém, se demorasse, pegaram-no os homens pela mão, a ele, a sua mulher e as duas filhas, sendo-lhe o Senhor misericordioso, e o tiraram, e o puseram fora da cidade.
17 Den one of di angels kon sey, “Make una run! Make nobody look back and make una nor stop for di valley until una rish di mountin, so dat nobody go die.”
17 Havendo-os levado fora, disse um deles: Livra-te, salva a tua vida; não olhes para trás, nem pares em toda a campina; foge para o monte, para que não pereças.
18 But Lot ansa, “No! Abeg sir, nor let us run dat kind race.
18 Respondeu-lhes Ló: Assim não, Senhor meu!
19 Una don do betta tin for mi and my family as una save awa life. But di mountins too far, before wi go run rish der, di fire go kill us for road.
19 Eis que o teu servo achou mercê diante de ti, e engrandeceste a tua misericórdia que me mostraste, salvando-me a vida; não posso escapar no monte, pois receio que o mal me apanhe, e eu morra.
20 E get one small town for der and e nor too far. Abeg, make mi and my family run go der. If yu look, yu go know sey na small town and wi go dey save for der.”
20 Eis aí uma cidade perto para a qual eu posso fugir, e é pequena. Permite que eu fuja para lá (porventura, não é pequena?), e nela viverá a minha alma.
21 Di angel kon sey, “Okay, I gri. I nor go distroy dat town.
21 Disse-lhe: Quanto a isso, estou de acordo, para não subverter a cidade de que acabas de falar.
22 So make una run go der, bikos I nor go fit do anytin until una rish der.” So na-im make dem dey koll di town Zoar, bikos Lot koll am, “small place”.
22 Apressa-te, refugia-te nela; pois nada posso fazer, enquanto não tiveres chegado lá. Por isso, se chamou Zoar o nome da cidade.
23 Sun just dey kom out wen Lot and en family rish Zoar.
23 Saía o sol sobre a terra, quando Ló entrou em Zoar.
24 Den God send sulfur and fire like rain kom Sodom and Gomorrah
24 Então, fez o Senhor chover enxofre e fogo, da parte do Senhor , sobre Sodoma e Gomorra.
25 kon distroy dem, plus di valley with all di pipol for der and evritin wey dey grow for di land.
25 E subverteu aquelas cidades, e toda a campina, e todos os moradores das cidades, e o que nascia na terra.
26 But Lot wife look back and e kon turn to salt.
26 E a mulher de Ló olhou para trás e converteu-se numa estátua de sal.
27 For di next morning, Abraham rush go di place where e for stand for God present before.
27 Tendo-se levantado Abraão de madrugada, foi para o lugar onde estivera na presença do Senhor ;
28 E look face Sodom and Gomorrah side and all di valley, but na only smoke e si wey dey kom out from der.
28 e olhou para Sodoma e Gomorra e para toda a terra da campina e viu que da terra subia fumaça, como a fumarada de uma fornalha.
29 But wen God distroy di town and valley where Lot dey stay. E keep Abraham for en mind kon allow Lot run komot di town.
29 Ao tempo que destruía as cidades da campina, lembrou-se Deus de Abraão e tirou a Ló do meio das ruínas, quando subverteu as cidades em que Ló habitara.
30 Bikos Lot dey fear to stay for Zoar, en and en dotas kon go di mountins go hide for one hole.
30 Subiu Ló de Zoar e habitou no monte, ele e suas duas filhas, porque receavam permanecer em Zoar; e habitou numa caverna, e com ele as duas filhas.
31 Di senior dota kon tell en sista, “Si! Awa papa don dey old and e nor get anybody for di whole world wey go marry and sleep with us, so dat wi go get shidren.
31 Então, a primogênita disse à mais moça: Nosso pai está velho, e não há homem na terra que venha unir-se conosco, segundo o costume de toda terra.
32 So, make wi give awa papa enough drink and wen e don high, wi go sleep with am, so dat wi go get belle kon born pikin thru am.”
32 Vem, façamo-lo beber vinho, deitemo-nos com ele e conservemos a descendência de nosso pai.
33 So dat nite, dem kon make dia papa drink well-well and wen e don high and e nor know wetin e dey do again, di senior dota kon sleep with am.
33 Naquela noite, pois, deram a beber vinho a seu pai, e, entrando a primogênita, se deitou com ele, sem que ele o notasse, nem quando ela se deitou, nem quando se levantou.
34 Di next day, di senior dota kon tell en sista sey, “I sleep with papa yestiday nite; so make wi gi-am plenty drink today again, so dat yu go sleep with am.”
34 No dia seguinte, disse a primogênita à mais nova: Deitei-me, ontem, à noite, com o meu pai. Demos-lhe a beber vinho também esta noite; entra e deita-te com ele, para que preservemos a descendência de nosso pai.
35 Dat nite, di girls kon make dia papa drink well-well and wen e don high and e nor know wetin e dey do again, di junior dota kon sleep with am.
35 De novo, pois, deram, aquela noite, a beber vinho a seu pai, e, entrando a mais nova, se deitou com ele, sem que ele o notasse, nem quando ela se deitou, nem quando se levantou.
36 Like dis, Lot kon give en dotas belle.
36 E assim as duas filhas de Ló conceberam do próprio pai.
37 Di senior one born boy and e kon koll am Moab wey bi Moab pipol papa.
37 A primogênita deu à luz um filho e lhe chamou Moabe: é o pai dos moabitas, até ao dia de hoje.
38 Di junior one born boy too and e kon koll am Ben-Ammi and na-im bi Ammon pipol papa.
38 A mais nova também deu à luz um filho e lhe chamou Ben-Ami: é o pai dos filhos de Amom, até ao dia de hoje.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 19, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.