1 To get good name betta pass perfume wey dear well-well and di day wen pesin die,
2 E betta to go house where dem for dey kry
3 E betta make pesin dey tink about life,
4 Pesin wey always dey tink about happiness, na fool,
5 E betta make wise pesin korrect yu
6 Bikos just as shuku-shuku dey burn for fire,
7 True-true, opreshon fit turn wise man to fool,
8 To finish anytin wey yu start, betta pass wen yu start am,
9 Always dey kontrol yor tempa,
10 Nor ever ask, “Wetin make evritin bad dis days pass as dem bi before?”
11 Wisdom dey sweet well-well wen money dey,
12 Wisdom and money fit give yu anytin wey yu wont for life,
13 Make yu asept di way God kreate tins;
14 Wen God give yu money, make yu tank God and enjoy am,
15 I don si evritin for dis yuzles life;
16 So make yu nor dey too good or too wise,
17 Make yu nor dey too wiked or bihave like fool,
18 But make yu listin to all dis warnin,
19 Pesin wey wise,
20 bikos e nor get anybody for dis world
21 So, make yu nor listin to wetin pipol dey tok,
22 bikos yu know for yor own heart too,
23 I dey always try my best make wisdom
24 Evritin wey don happen, too hard for human being to undastand;
25 So I try to search evriwhere to get wisdom
26 I still si sey, woman wey wont make man sleep with am,
27 Di Tisha sey: “I undastand all dis tins wen I dey try to look for ansa to evritin.
28 “Wetin I dey find since, I neva still si am;
29 But I still learn dis one too: