Deuteronômio 32

PCM

1 Heavens make una listin to mi as I dey tok;

2 Make wetin I dey tish una, fall on-top una like rain;

3 Bikos I go tok about God name

4 Na-im bi di Rock;

5 En pipol nor dey respet or fear am;

6 Dis pipol wey nor get sense at-all,

7 Make una remember as e bi before,

8 Wen di God of all ogas give di nashons dia propaty;

9 Na God get di pipol for Israel;

10 Na empty dirty land for wildaness E for si dem.

11 Just as di eagle dey wosh en house

12 Na God dey guide dem by ensef,

13 E allow dem travel pass di high place for di land

14 E feed dem with milk from di animals

15 But Israel pipol kon fat and wiked more-more.

16 Dem make am jealous,

17 Instead make dem sakrifice give God,

18 Dem don forget di Rock wey bi dia papa

19 So wen God si all dis tins,

20 God sey, “I go rijet dem,

21 Dem don make mi dey vex

22 Bikos my vexnashon don kause fire

23 I go inkrease dia wahala,

24 Honga go kill dem,

25 Di swod go bring deat for outside and for inside,

26 “I sey, ‘I won kut dem to pieces.

27 But I nor go like how di enemies go si am,

28 Dem bi pipol wey nor get sense

29 How I wish sey dem get sense and fit undastand dis tins

30 How one pesin go fit porshu 1,000 among dem

31 Bikos awa enemies rock nor bi like awa Rock

32 Dia vine na from Sodom and Gomorrah field.

33 Dia wine na snake poizin

34 God sey, “I nor dey keep all dis tins

35 I go revensh and pay dem back wen dem go fall,

36 God go judge en pipol

37 E go sey, “Where una gods,

38 wey dey chop di best for una sakrifice

39 God sey, “Na Mi, bi Mi!

40 Bikos I raiz my hand go heaven kon sey,

41 I go make my lite sharp like swod

42 I go make my arrow full with blood

43 My pipol, make una happy,

44 Den Moses go with Joshua, Nun pikin kon sing all di word for di song give di pipol.

45 Wen Moses don sing di song give Israel pipol,

46 e kon tell dem, “All dis words wey I dey tell una today, make una keep am for una mind; una must kommand una shidren to obey all dis law and kommand.

47 All dis nor bi ordinary word, but dem dey give life! Wen una obey dis word, una go get long life for di land wey una go soon cross Jordan River enter.”

48 Dat same day, God tell Moses,

49 “Make yu go Abarim hill kountry for Mount Nebo (where bi Moab land opposite Jeriko) den look Kanaan land wey I won give Israel pipol as dia own.

50 Yu go die for dat mountin wey yu go klimb kon go join yor grand-grand papa dem, just as Aaron yor broda die on-top Mount Hor kon join en grand-grand papa,

51 bikos di two of una sin against mi for Israel pipol front for Meribah Kadesh wota for Zin wildaness, wen yu nor respet mi as yu suppose to.

52 Yu go si di land, but yu nor go enter di land wey I dey give to Israel pipol.”

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado