1 Crônicas 16

PCM

1 Dem karry di Kovenant Box go put for di tent wey David make for am. Den dem do sakrifice kon woship God.

2 Afta David don give di sakrifice finish, e kon bless di pipol with God name and

3 all of dem kon chop beleful. E give bread, meat wey dem roast and rice to each pesin for Israel.

4 David tell some Levi pipol sey, make dem lead di pipol as dem dey woship for di Kovenant Box front kon dey sing and praiz di Oga wey bi Israel pipol God.

5 Dem sey make Asaf lead dem, while Zekaraya go dey help am. Den make Jeiel, Shemiramot, Jehiel, Mattitaya, Eliab, Benaya, Obed-Edom and Jeiel play harp, while Asaf go dey play di cymbal.

6 Na Priest Benaya and Priest Jahaziel dey blow di trumpet for di Kovenant Box front.

7 Dat day, David first sey make Asaf with all Levi pipol sing dis song take tank God:

8 “Make una tank and koll God name!

9 Make una sing dey praiz God!

10 Make una boast about en name wey dey holy!

11 Make una go meet God and E go help una!

12 Make una remember all di mirakles wey E do,

13 bikos na una bi Israel shidren-shidren; God savant;

14 Na-im bi di Oga awa God!

15 Make una nor forget wetin dey God kovenant;

16 just as E promise Abraham and Isaak.

17 God give en kovenant to Jakob

18 E sey, ‘I go give yu Kanaan land

19 Dat time, God pipol nor many

20 Dem dey waka from kountry to kountry

21 God nor let anybody opress dem;

22 ‘Make una nor tosh di pipol wey I choose

23 Make evribody for di eart sing to God!

24 Make una tell di world about en glory

25 Bikos God dey great and evribody must praiz

26 Di gods for oda towns nor mean anytin,

27 Na-im get glory and majesty!

28 Make evribody praiz God!

29 Make una give God di praiz

30 Make evritin wey dey dis world fear God!

31 Make di heavens and eart dey happy!

32 Make di sea and evritin wey dey inside, shaut!

33 Den make all di trees for bush shaut with joy for God,

34 Make una tank God, bikos E dey good,

35 Make una pray kon sey,

36 Make di Oga wey bi Israel God get all di praiz

37 King David sey make Asaf and some Levi pipol dey lead di pipol as dem dey woship God for di tent where di Kovenant Box dey and na der dem go for dey do dia work evriday.

38 Dem still choose Obed-Edom wey bi Jedutun pikin and 68 oda men. Na Hosah and Obed-Edom dey guide di gate.

39 Na Priest Zadok and di oda priests dey serve for God house for Gibeon.

40 Evry morning and evening, dem dey offa burnt sakrifice for di altar, just as dem rite am for God Law Book.

41 Odas wey join dem na: Heman, Jedutun and di odas wey dem choose to dey praiz God, “Bikos en love dey forever.”

42 Na Heman and Jedutun dey kontrol how dem dey play di trumpets, cymbals and di oda tins wey dem take dey praiz God. Na Jedutun sons dey guide di gate.

43 Den evribody go back to en house and David go en house too go bless en family.

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado