1 Crônicas 15

PCM

1 David build many house for ensef for en own town. E still make one place for God Kovenant Box.

2 David kon sey, “Na only Levi pipol go karry di Kovenant Box, bikos na dem God choose to karry di box and serve am forever.”

3 So David gada Israel pipol go Jerusalem make dem go bring di Kovenant Box kom di place wey e make for am.

4 So e sey make dem koll Levi pipol and Aaron shidren-shidren kom.

5 From Kohat family:

6 From Merari family:

7 From Gershom family:

8 From Elizafan family:

9 From Hebron family:

10 and from Uzziel family:

11 David koll Priest Zadok and Priest Abiatar with six pipol form Levi tribe and dem bi: Uriel, Asaya, Joel, Shemaya, Eliel and Amminadab.

12 E tell dem, “Na una bi leaders for Levi tribe. Make una klean all Levi pipol and unasef, so dat una go fit bring di Oga wey bi Israel God, Kovenant Box kom di place wey I make for am.

13 God ponish us, bikos una nor dey der to karry am for di first time and wi nor woship am as wi suppose to.”

14 Den Levi pipol and di priest kon klean demsef, so dat dem go fit karry Israel God Kovenant Box.

15 Levi pipol karry di box for pole kon put am for dia shoulder, just as God kommand thru Moses, en savant.

16 David still kommand Levi leaders sey, “Make Levi pipol use harp and cymbals take play music.”

17 So Levi pipol appoint: Heman wey Joel born and Asaf wey bi Berekaya pikin, bikos dem bi dia relashon. Di next pesin na Kushaya pikin, Etan wey kom from Merari family.

18 Di pipol wey dem choose to assist dem na: Zekaraya, Jaaziel, Shemiramot, Jehiel, Unni, Eliab, Benaya Maaseaya, Mattitaya, Elifelehu, Mikneaya and Obed-Edom and Jeiel wey dey guide di gate.

19 Doz wey dey sing na Heman, Asaf, Etan and na dem dey play di bronze cymbals;

20 Zekaraya, Aziel, Shemiramot, Jehiel, Unni, Eliab, Maaseaya and Benaya dey play di harps.

21 Mattitaya, Elifelehu, Mikneaya, Obed-Edom, Jeiel and Azazaya dey play di lyres.

22 Bikos Kenanaya sabi play music well-well, dem kon make am dia leader.

23 Dem choose Berakaya and Elkanah make dem dey guide di Kovenant Box.

24 Doz wey dem choose to blow trumpet for di Kovenant Box front na: Shebanaya, Joshafat, Netanel, Amasai, Zekaraya, Benaya and Elieza and all of dem na priests. Dem still choose Obed-Edom and Jehaya make dem dey guide di box too.

25 So King David, Israel leaders and all di sojas oga, go Obed-Edom house go karry di Kovenant Box kom Jerusalem and dem kon dey sing and dance.

26 Dem sakrifice seven bull and seven ram, bikos God dey help di Levi pipol wey karry di Kovenant Box.

27 Doz wey dey play music, with Shenanaya wey bi dia leader and Levi pipol wey karry di box, wear one robe wey dem make with fine linen. David too dress like priest and e wear robe too.

28 So evribody for Israel follow di Kovenant Box go rish Jerusalem dey happy, dey play trumpets, horns and cymbals kon dey sing and dance.

29 As dem bring di box enter di town, Saul dota, Mikal look thru window kon si David en husband dey dance anyhow, so e kon dey vex for am.

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado