1 God sey, “For dat day, I go open one place where wota go for rush kom wosh David shidren-shidren and Jerusalem pipol from all dia sins and all di bad-bad tins wey dem dey do.
2 For dat day, I go remove all di juju name from di land and nobody go remember dem again. I go kill anybody wey klaim sey en na profet, den pipol mind nor go dey to go woship or serve juju again.
3 But if anybody still get di mind to lie sey e dey profesai, na en own papa and mama go tell am sey, ‘Na deat go bi yor own, bikos yu dey lie with God name.’ Den if e still profesai, en papa and mama go shuk am die with swod.
4 “For dat day, no profet go fit karry body up, bikos of en vishon. Nobody go sey en na profet or wear profet garment kon dey deceive pipol.
5 Instead, e go sey, ‘I nor bi profet. Na farmer work I dey do since my mama born mi.’
6 Den if pesin ask am, ‘So na who wound yu for yor chest?’ E go ansa, ‘Na my friend house I for wound.’ ”
7 God wey dey mighty sey,
8 and if dem divide all di pipol
9 I go test di third part wey survive kon klean dem,