1 As Jesus and en disciples near Jerusalem, dem kom rish Betpage for Mount Olives, so Jesus send two disciples
2 kon tell dem, “Make una go di village wey dey una front. Una go si one donkey and en pikin wey dem tie for der. Make una luz and bring dem kom meet mi.
3 If anybody ask, ‘Why una dey luz di donkey dem?’ Make una ansa, ‘Di oga nid dem and e go bring dem kom back naw-naw.’ ”
4 Dis tin happen so dat wetin di profet tok, go bi true:
5 “Tell Zion pipol,
6 Di disciples kon go do as Jesus tell dem.
7 Dem bring di donkey kon put dia klot make Jesus for sidan on-top.
8 Many pipol spread dia klot for road. Odas kut palm leaf kon spread dem for road too.
9 Pipol wey dey go for Jesus front and dem wey dey follow am for back kon dey shaut,
10 As Jesus enter Jerusalem, di town skata and pipol kon dey ask, “Who bi dis?”
11 Pipol wey dey follow Jesus kon sey, “Dis na Jesus, di profet from Nazaret wey dey Galilee.” Jesus dey ride donkey enter Jerusalem|alt="jJesus riding a donkey into Jerusalem" src="lb00315c.tif" size="col" loc="MAT 21:1-11" copy="LB" ref="21:11"
12 Den Jesus enter di temple aria kon drive all di pipol wey dey buy and sell inside di temple, e skata di tabol and chair wey di pipol dey take shange money and sell dove.
13 Jesus kon tell dem, “God word sey, ‘Dem go koll my house, “Prayer House” ’, but una don turn am to where tif dey hide put!”
14 Jesus heal pipol wey blind and doz wey nor fit waka inside di temple yard.
15 But wen di priest oga dem and di law tishas si di wonderful tins wey Jesus dey do and hear shidren dey shaut, “Praiz, David Pikin” for inside di temple, dem kon dey vex.
16 So di priest oga dem and di tishas kon ask Jesus, “Yu dey hear wetin dem dey tok?”
17 Jesus kon leave dem go Betany kon stay der till day break.
18 For early morning, as Jesus dey go back to di town, e kon dey hongry.
19 E si one fig tree for road kon waka go where e dey, but e nor si anytin plok, bikos na only leaf di tree get. So e kon tell di tree, “Yu nor go ever bear fruit again!” At wons, di fig tree kon bigin die.
20 Wen di disciples si wetin happen, dem sopraiz kon sey, “Wetin make dis fig tree kwik die like dis?”
21 Jesus ansa dem, “I tell una true word, if una get faith and una nor dey doubt, una nor go only do wetin happen to dis fig tree, but if una tell dis mountin, ‘Make yu move go inside di sea, e go-go.’
22 If una bilive, una go get anytin wey una ask for, wen una pray.”
23 Afta Jesus enter di temple, di priest oga dem and di eldas kon ask am wen e dey tish sey, “Na wish pawa yu take dey do all dis tins and who give yu di pawa?”
24 Jesus ansa dem, “I won ask una one kweshon. If una ansa mi, den misef go tell una wish pawa I take dey do dis tins.
25 Where John baptizim from kom? Na from heaven or pipol?”
26 But if wi sey, ‘Na from pipol,’ wi dey fear di pipol, bikos dem bilive sey na profet John bi.”
27 So dem ansa Jesus, “Wi nor know.”
28 “Wetin una tink? One man get two boys. E tell one, ‘My pikin, go work for my farm today.’
29 “Di boy ansa, ‘I nor go-go.’ But afta, e shange en mind kon go.
30 “Di papa kon tell di oda boy di same tin. Dis one kon ansa, ‘I go-go sir,’ but e nor go.
31 “Wish of di two shidren do wetin dia papa wont?”
32 John di Baptist kom show una di true road and una nor bilive am. But tax kollectors and ashawo dem bilive am. Even wen una si all dis tins wey I do, una still nor shange una mind kon bilive God.”
33 “Make una hear anoda parabol: One man plant vine for en farm, fence am round, dig pit where dem go for press di fruit wey dem go take make wine and build where sekurity go stay. Den e rent di farm give farmers kon travel go far place.
34 Wen harvest time rish, e send en savants go meet di farmers make dem gi-am en own share.
35 “But di farmers seize di savants, beat one, kill one and stone di oda one.
36 Den di man kon send some oda savants wey plenty pass di first ones go meet di farmers and dem do di same tin to dem.
37 At last, e send en own pikin go, dey tink sey, ‘May bi dem go respet my pikin.’
38 “But wen di farmers si di boy, dem kon tell each oda, ‘Di landlord pikin wey go inherit en papa propaty afta e don die, na-im dey kom so. Make wi kill-am and kollect wetin go bi en own.’
39 So dem seize am, trow am komot from di farm kon kill-am.
40 “Wen di man wey get di farm go kom, ‘Wetin una tink sey e go do doz farmers?’ ”
41 Dem ansa Jesus, “E go distroy doz evil pipol! Den e go hire di farm give oda farmers wey go gi-am wetin bi en own, wen harvest time rish.”
42 Jesus kon tell dem, “Una neva read God word wey sey:
43 “Na dis make mi tell una sey, ‘Dem go take God Kingdom from una and dem go gi-am to pipol wey go bear di kind fruit wey E wont.’
44 Di pesin wey fall for dis stone go skata and di pesin wey dis stone go fall on-top, go grind to powder.
45 “Wen di priest oga dem and di Farisee pipol hear Jesus parabols, dem kon know sey e dey tok about dem.
46 So dem kon dey try to arrest Jesus, but dem dey fear, bikos di pipol bilive sey na profet e bi.”