Lucas 1

PCM

1 Many pipol don rite di story about di tins wey happen among us,

2 as di pipol wey si dem wen dem happen, tell us.

3 My oga Teofilus, since I follow evritin from biginnin, I kon tink am sey e good make I rite wetin really happen give yu,

4 so dat yu go undastand di tins wey dem tish yu well-well.

5 For di time wen Herod bi King for Judea, one priest dey wey en name na Zekaraya from Abijah family and en wife name na Elizabet, wey kom from Aaron family.

6 Dem dey do wetin God like, dey follow all di tins wey God tok for en word.

7 Dem nor get pikin, bikos Elizabet nor fit get belle and dem don old well-well.

8 E kom rish Zekaraya family turn to do priest work for di temple

9 and as dia custom bi, dem kon choose Zekaraya make e enter inside God Temple go burn incense.

10 Wen di time to burn incense don rish, all di pipol kon gada for outside dey pray.

11 God angel appear to Zekaraya for di altar side near where dem for dey burn incense.

12 As Zekaraya si di angel, fear katch am well-well and e kon dey shake.

13 But di angel tell am, “Make yu nor fear Zekaraya, bikos God don hear yor prayer. Yor wife Elizabet go born boy pikin for yu and yu go koll am, ‘John.’

14 Di pikin go bring joy and happiness for yu and many pipol go happy well-well wen dem born am,

15 bikos God go use am well-well. E nor go drink wine or strong drink, but di Holy Spirit go dey inside am, even before dem go born am.

16 E go make many pipol follow God.

17 E go first kom with Elijah spirit and pawa, before di Oga God ensef go kom. E go make papa setol with dia shidren and pipol wey nor dey obey God before, e go make dem obey am naw, so dat dem go dey ready to meet am for heaven.”

18 Zekaraya ask di angel, “How I go take know sey wetin yu tok so go happen? Bikos mi and my wife don old well-well.”

19 Di angel ansa, “I bi Gabriel, wey dey stand for God present and na-im send mi kom tell yu dis Good News.

20 But since yu nor bilive wetin I tok so, yu nor go fit tok again, until di day wen dis tins go happen.”

21 So di pipol wey dey wait for Zekaraya kon bigin wonder why e stay tey inside di temple.

22 Wen e kom outside, e nor fit tok again. Dem kon know sey e don si vishon for inside di temple, bikos e use hand take make sign for dem.

23 Wen en time to work inside di temple finish, e kon go house.

24 Wen e don tey small, Elizabet, wey bi Zekaraya wife kon get belle and e kon hide ensef inside house for five monts.

25 So Elizabet kon sey, “God don do big tin for mi for my old age, E don favor mi for pipol present and E don komot shame for my face.”

26 Wen Elizabet belle don rish six monts, God kon send angel Gabriel go Nazaret, one small town for Galilee,

27 go meet Mary. Dis Mary neva ever sleep with man before and na-im Josef wey kom from David family, won marry.

28 Di angel kon tell am, “I salot yu o-o! Yu wey God don favor, bikos E dey with yu.”

29 But Mary dey fear, bikos of wetin di angel tok and e bigin wonder wetin di greetin mean.

30 Den di angel tell am, “Make yu nor fear, Mary, bikos God don favor yu!

31 Make yu listin, yu go get belle kon born boy and yu go name am, ‘Jesus.’

32 E go big well-well and dem go koll am God wey dey for heaven pikin and God go gi-am en papa David throne.

33 Na-im go rule Jakob house forever and en kingdom nor go ever end.”

34 Mary tell di angel, “How dis tins go fit happen, as e bi sey I neva sleep with man before?”

35 Di angel ansa am, “Di Holy Spirit pawa go kover yu. So di pikin wey yu go born, go dey holy and dem go koll am God Pikin.

36 Si, yor kousin Elizabet don get belle for six monts naw and e go born boy for en old age, even doh dem tok sey e nor go fit get belle.

37 Bikos e nor get anytin wey God nor fit do.”

38 Mary kon sey, “Yes, I bi God savant, make wetin yu tok so, happen to mi.” Den di angel kon leave am.

39 Afta two days, Mary kon get up rush go Judah

40 and e enter Zekaraya house go greet Elizabet.

41 Wen Elizabet hear as Mary dey greet am, di pikin for en belle jump and di Holy Spirit kon enter Elizabet body.

42 So Elizabet kon sey, “God don bless yu pass evry woman and E don bless di pikin wey dey yor belle!

43 Who I bi wey make my Oga God mama kom visit mi?

44 Bikos as yor greetin rish my ear, di pikin wey dey my belle kon happy bigin jump.

45 And God don bless yu, bikos yu bilive sey wetin E tok, go happen.”

46 Mary kon sey,

47 and my spirit dey happy

48 don si en savant kondishon.

49 bikos E don do big-big tins for mi

50 E dey show en mesi to evribody wey dey fear am

51 E don do many big-big tins with en pawa

52 E don remove rulers from dia throne and pipol wey bring demsef down,

53 E don make doz wey dey hongry beleful with good food and pipol wey get money well-well,

54 E help en savants,

55 wey E promise awa grand-grand papa dem

56 Mary stay with Elizabet for about three monts, den e kon go back to en house.

57 Di time kon rish for Elizabet to born, so e kon born boy.

58 En neighbour and rilashons hear sey God don do big tin for am, so dem kom happy with am.

59 Wen di pikin rish eight days, dem sekonsaiz am, won kon gi-am en papa name, Zekaraya.

60 But en mama sey, “No, dem must koll am John.”

61 Dem kon sey, “But e nor get any of una relashon wey en name bi John.”

62 So dem make sign give Zekaraya ask sey, “Wetin wi go koll di pikin.”

63 Zekaraya ask for sometin make e rite put, den e kon rite, “En name na John.” So, all of dem kon sopraiz well-well.

64 Den Zekaraya mout open and e kon bigin praiz God.

65 Fear katch all dia neighbour and for evriwhere for Judea, na di matter dem kon dey tok about.

66 So evribody wey hear wetin happen, keep am for dia mind dey sey, “Wish kind pikin dis one go bi sef?” Bikos God dey with am true-true.

67 Den di Holy Spirit enter Zekaraya and e kon bigin profesai, dey sey,

68 “Make wi praiz Israel God,

69 E send di Savior wey get pawa kom meet us,

70 God promise en profet before-before

71 sey, wi go dey save from awa enemy

72 E do dis tins to show en love for awa grand-grand papa dem

73 Even awa papa Abraham sey,

74 ‘E go save us from awa enemy hand,

75 and wi go dey holy and good for en eye

76 And yu, my pikin, pipol go koll yu God profet

77 wey go make pipol know sey, God go save dem,

78 Since God love and en kindness strong well-well,

79 so lite go shine for di pipol wey sidan for darkness

80 Di pikin kon dey grow and strong for spirit. E stay for wildaness until di day wen God show am to Israel pipol.

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado