Juízes 17

PCM

1 E get one man, e name na Mikaya and e dey stay for Efraim hill kountry.

2 One day, e tell en mama, “Yor 1,000 one hundred silva wey dem tif wey kon make yu curse di tif, dey my hand.” Na mi tif am.

3 So e give di money back to en mama, den di mama sey, “Bikos I nor wont make di curse follow my pikin, I dey dedikate dis money give God. I go use am take buy wood kon make juju wey dem kover with silva.”

4 So wen di pikin give en mama di money, di woman take two hundred silva kon give pesin wey turn am to juju and dem kon put am for Mikaya house.

5 So, Mikah build shrine for di juju, den e make one priest garment kon wear am for en pikin, so dat e go bi en priest.

6 Dat time, Israel pipol nor get king; so all di pipol dey do wetin dem like.

7 One day, one Levi man wey dey stay Betlehem for Judah kon kom di aria.

8 E komot for Betlehem go look for anoda place where e go stay. Wen e dey travel, e kon rish Mikah house for di hill kountry wey dey Efraim.

9 Mikah ask am, “Na where yu from kom?”

10 So, Mikah tell am, “Yu fit stay here with mi and yu go bi my papa and priest. Evry year, I go dey give yu ten silva, klot and food.”

11 Di Levi man gri and e kon bi priest like Mikah pikin too.

12 So e stay Mikah house and Mikah kon make di man e own pesinal priest.

13 Den Mikah sey, “I know sey God go bless mi naw, bikos I get Levi pesin as my priest.”

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado