1 As King Hezekaya hear di ripot, e vex tear en klot kon wear sak klot go God temple.
2 E send Eliakim wey bi di offisa wey dey kare for di palis, Shebna wey bi di kourt seketry and di senior priest go meet Profet Isaya wey bi Amos pikin and all of dem wear sak klot too.
3 Dis na di message wey e send dem: “Today na trobol day, bikos dem don ponish and disgrace us well-well. Wi bi like woman wey won born, but wi too weak to even push.
4 Assyria king don send en offisa oga kon curse God. Make God wey bi yor God hear dis curse, so dat E go ponish di pipol wey curse am. So make una pray to God for all awa pipol wey remain.”
5 Wen Profet Isaya si Hezekaya message wey e send thru en savants,
6 e kon sey, “Make una tell di king: ‘Dis na wetin God tok: “Make una nor fear bikos of all di tins wey una hear and di curse wey Assyria king savant curse mi.
7 Si, mi God go kontrol en mind; e go hear one news wey go make am run go back to en kountry, den I go kill-am for der.” ’ ”
8 Wen Assyria offisa oga kom back from Jerusalem kon hear sey di king don komot from Lakish go fight against Libnah town wey near dem, e kon go meet and tok to am for der.
9 Dem kon tell Assyria sojas sey, Egypt sojas wey King Tirhakah for Sudan dey lead, dey kom attack dem. As di king hear dis tin, e kon send leta go give King Hezekaya
10 for Judah sey, “Di God wey yu dey trust don tell yu sey I nor go fit kill yu, but make yu nor let dat one deceive yu.
11 Yu don hear wetin Assyria king dey do any kountry wey e won distroy. Yu tink sey yu fit eskape from am?
12 Na my papa dem distroy Gozan, Haran and Rezef town and dem kill Eden pipol for Telassar and no god fit save dem.
13 Where di king dem wey dey for Hamat, Arpad, Sefarvaim, Hena and Ivvah town?”
14 Den, King Hezekaya kollect di leta from di messenja, read am kon take am go put for God altar for di temple,
15 den e pray,
16 “Israel God wey get pawa; di Pesin wey sidan for where high pass di creatures wey get feadas. Na only Yu bi God wey dey rule all di kingdoms for dis world. Na Yu kreate di eart and di sky.
17 Naw, my Oga God, make Yu hear and si wetin dey happen to us. Make Yu listin to all di tins wey King Sennakerib dey use take curse Yu wey bi God.
18 “Oga God, all of us know sey, Assyria king don distroy plenty nashons kon skata dia lands;
19 e burn all dia gods wey nor bi god at-all, bikos dem bi image wey human being use dia hands make.
20 Naw, Oga wey bi awa God, make Yu save us from Assyria pipol, so dat all di nashons for di world go know sey, na Yu bi God.”
21 Den Profet Isaya send message go tell King Hezekaya about en prayer sey,
22 “God sey, ‘Jerusalem town dey laf and play with King Sennakerib.
23 “ ‘Who yu tink sey yu dey curse and laf since?
24 Yu send yor savant kom boast give mi
25 kon dig well and drink betta wota for pipol land.
26 So, yu neva hear sey na so I plan all dis tins since?
27 Doz wey dey stay der nor bin get pawa
28 I know evritin about yu; di tins wey yu dey do,
29 Di way yu dey karry body up and make mout,
30 Den Profet Isaya tell King Hezekaya sey,
31 Doz wey go survive for Judah,
32 Pipol go survive for Jerusalem and Mount Zion,
33 So dis na wetin God tok about Assyria king:
34 E go pass di same road wey e take kom go back
35 I go defend and protet dis town,
36 So God angel go Assyria kamp for nite kon kill 185,000 sojas. All of dem die before day break!
37 Den King Sennakerib for Assyria kon go back to Nineveh.
38 One day wen e dey woship for Nisrok wey bi en god temple, Adrammelek and Shareza wey bi en sons kon shuk am die with dia swod, den dem run go Ararat land. En pikin Esarhaddon kon take-ova as king.