1 Dis message na about Egypt:
2 God sey, “I go make war happen for Egypt, dat time,
3 I go distroy Egypt pipol with fear kon make dia plans yuzles.
4 I go give Egypt pipol to one bad ruler and na wiked kings go rule dem.
5 River Nile go dry
6 Di place where di river dey flow from go dey smell
7 All di plants wey dey float on-top di river, go dry;
8 Fishermen go kry well-well.
9 Pipol wey dey make linen klot,
10 Pipol wey dey weave and doz wey dem hire to work,
11 Zoan leaders na fools!
12 And naw, where doz wise men wey dey advise di king?
13 Zoan and Memfis leaders na fools.
14 God don konfuse dem; dem dey give wrong advise and evritin wey Egypt pipol dey do,
15 So, work or any betta tin nor go dey Egypt again;
16 For dat time, Egypt pipol go bi like wimen. Dem go shake dey fear bikos Oga God wey dey lead heaven sojas don dey ready to ponish dem.
17 Den Judah pipol go sofa Egypt pipol and anybody wey go hear Judah pipol story, go dey fear, bikos of wetin God wey dey lead heaven sojas won do dem.
18 For dat time, five towns for Egypt go dey speak Kanaan language kon promise to serve God. Dem go koll one of di town, “Sun town.”
19 For dat time, dem go build one altar for God for di middle for Egypt, with one holy pila wey dem go dedikate give God for Egypt boundary.
20 E go dey remind pipol for Egypt about God. Wen dem dey opress di pipol and dem koll God make E kom help dem, E go send pesin go diliver and help dem.
21 God go show ensef to Egypt pipol; dem go woship am with ofrin and sakrifice kon know am well-well. Dem go promise God and do wetin dem promise.
22 Even doh God go ponish Egypt pipol, E go still heal dem again. Dem go turn to am and E go hear dia prayer kon heal dem.
23 Wen dat time rish, betta road go dey between Assyria and Egypt. Pipol for di two kountry go dey travel go visit each oda and di two nashon go woship togeda.
24 Wen dat time rish, Israel pipol go bi di same with Egypt and Assyria pipol and dis three nashon go bi blessing to di whole world.
25 God wey get pawa go bless dem kon sey, “Egypt wey bi my pipol, I go bless una. Assyria pipol wey I kreate and Israel pipol wey I don choose, I go bless una well-well too.”