1 Before-before, God tok to awa grand-grand papa dem for many ways, thru di profets,
2 but naw, E dey tok to us thru en pikin wey get evritin and na thru am, E kreate di world.
3 Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.
4 E big pass di angels, just as di name wey God gi-am big pass angels own too.
5 Na wish angel God tell sey, “Yu bi my pikin, today I don bikom yor Papa?” Or as E tok for anoda place sey, “I go bi yor Papa and yu go bi my pikin?”
6 But wen God won send en first-born enter dis world, E sey: “Make all my angels woship am.”
7 God tok about di angels sey, “I make my angels and my savants spirit to dey burn like fire,”
8 but koncerning en pikin, E sey:
9 Yu love to do good and yu hate wikedness.
10 E still tell di pikin sey:
11 Dem go skata, but God go dey forever.
12 and like klot and koat,
13 Na wish angel God tell, “Sidan for my rite hand until I go put all yor enemies under yor leg?”
14 All di angels na savants and na dem God send go prish for pipol wey go get salvashon.