1 Na snake play wayo pass any wiked animal wey God kreate. So di snake tell di woman, “Na true sey God sey, ‘Make una nor chop from all di tree wey dey di gardin’?”
2 Di woman ansa, “No o-o! Wi fit chop from all di fruit wey dey di gardin;
3 but about di fruit from di tree wey dey di gardin centre, God sey, ‘Una must nor chop or tosh am, bikos if una chop or tosh am, una go die.’ ”
4 So, di snake tell di woman, “True-true, una nor go die,
5 bikos God know sey wen una chop from di tree, una eyes go open and una go bi like God ensef, wey know wetin dey good or bad.”
6 Wen di woman si sey di fruit wey di tree dey produce fine well-well and e good to chop; and e go make pesin get sense well-well, e kon take some of di fruit chop. Di woman still give some to en husband wey dey with am and e kon chop too.
7 Den dem two eye kon open and dem kon know sey dem nor wear anytin; so dem sew fig leaf togeda kon take am kover dia body.
8 Den di man and en wife kon dey hear Oga God dey waka for di gardin wen evriwhere don kwayet for evening, so dem kon hide from di Oga wey bi dia God.
9 But God koll di man kon sey, “Where yu dey?”
10 Di man ansa, “I hear wen Yu dey waka for di gardin and fear kon katch mi, bikos I nor wear anytin, so I kon hide.”
11 So Oga God ask am, “Na who tell yu sey yu dey naked? Abi, yu don chop di fruit for di tree wey I sey make yu nor chop?”
12 Di man ansa, “Di woman wey Yu give mi bring some fruits from di tree and I kon chop am.”
13 Den Oga God tell di woman. “Wetin bi dis wey yu don do so?”
14 God kon tell di snake, “Bikos yu do like dis,
15 I go make yu hate woman
16 God kon tell di woman,
17 God tell Adam, “Yu obey yor wife kon chop from di tree wey I kommand yu sey, ‘Make yu nor chop from.’
18 E go dey bring out grass for yu,
19 Yu go sweat before yu chop,
20 Di man kon koll en wife Eve, bikos na en bi mama to evritin wey dey alive.
21 God use skin take make garment for Adam and en wife kon give dem make dem wear.
22 So God sey, “Naw wen man don bi like us, wen e don know wetin dey good and bad, make wi nor let am chop from di tree wey dey give life, if not, e nor go ever die.”
23 So Oga God kon porshu man and en wife komot from Eden Gardin, so dat e go-go farm for di groun where God from kreate am.
24 Wen God porshu dem komot, E kon put angels for di gate for di east side for di gardin with one swod wey dey bring fire and e dey turn face evriwhere. Dis one na to stop anybody wey won go near di tree wey dey give life.